You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Fake security alerts and wetin police say go happun to pipo wey dey behind dem
Di Nigeria Police Force don warn against di spread of fake news and false security alerts wey don dey on di rise for states across di federation, following di abduction of pupils and teachers from schools for Oyo and Borno states.
Police authorities give dis warning afta dem clear rumour of fake bandits and gunmen attacks for some southwest states, northern states, di Federal Capital Territory (FCT) plus some oda states for Nigeria.
Di police wey arrest some suspects wey dey behind di spread of di fake news and rumours of insecurity, tok say di misinformation dey cause panic, fear and confusion among kontri pipo.
Tori about schoolchildren and teachers abduction for Nigeria don give rise to fake security alarm.
For different states of di federation, police don debunk tori on banditry attacks for schools and communities wey turn out to be fake.
Dis rumours wey dey spread on social media especially on WhatsApp platforms don create fear, panic, and anxiety among kontri pipo, and e don create unnecessary tension within and around di affected areas, police tok.
Di false security alerts begin trend afta di abduction of school pupils and teachers for Oriire Local Govment Area of Oyo State southwest Nigeria and for three schools for Borno State, northeast Nigeria on 15 May.
Di most recent na di abduction of seven students from di Federal Polytechnic, Kaura Namoda for Zamfara State, on Wednesday, 3 June one of di students later escape.
Di kidnap of di former Minister of Power Bayo Adelabu sister and her twin children by armed men for Ibadan, Oyo State, also hapun di same day.
States wia pipo bin raise fake security alerts
Ogun state na di latest state to debunk anoda false security alert afta tori spread say suspected criminals dey inside one bus wey bin dey travel along Ibogun for Ifo area of di state.
Di police say dem quickly act and investigation show say di bus wey some youths don stop bin carry 21 labourers wey dey work for one construction company for di state.
"Further verification wey di police do, confam say say di workers dey legally employed for one ongoing federal project. Di report wey link dem to criminal activities na false and unfounded.
Earlier, di Ogun State Police Command bin arrest one Mr Johnson Elleh on top accuse say e produce and dey circulate misleading video wey allege say kidnapping and banditry activities bin dey go on along di Owode-Idiroko axis of Ogun State.
Di police say dem investigate di video and discova say na fake, plus di author design am to create fear, panic, and anxiety among members of di public.
Dem add say further investigation show say no kidnapping or banditry incident as e dey for di video happun for di area e mention.
For Lagos State, fake security alert wey claim say bandits don invade some parts of di state bin lead to di death of one 24-year-old motor-cycle rider.
Youths for one community bin label Kulaha Ayuba as suspected bandit afta one fake video spread on social media say armed bandits don enta Ibeju-Lekki, Imota, Oke-Afo plus oda parts of di state and dey target schools and children.
Dem beat am, tiff im bike and later drop im bodi for one swamp for di community.
Lagos State Police Command wey give di informate tok say di content for di video na fake and di intention na to create unnecessary fear and panic among residents.
Dem give assurance say no security crisis for di state and don arrest 15 suspects in connection wit di mata.
"Currently no security crisis, invasion, or coordinated attack on any school or community for Ibeju-Lekki, Imota, Oke-Afo, or any oda part of Lagos State. Di police reassure members of di public say schools across di state remain safe."
Di FCT police also debunk reports of one alleged kidnapping incident for Phase 1 Primary School, Gbagalape, Abuja on Thursday, 4 June.
Police say preliminary investigations show say di students just suddenly begin shout "kidnappers" and begin run out of di school premises, creating panic among teachers and members of di community.
Dem later close di school and findings show say no kidnapping incident happun, dem no sight any suspect, and no identify any victim.
Di same false security alert happun for Oyo state wia one viral voice note allege say armed bandits attack Lamini community and kill six residents.
Oyo state police say dem don arrest di pastor wey begin share di fake tori and di woman wey originate am.
Di State Intelligence Department (SID) bin carry out comprehensive investigation into di origin and dissemination of di false information wey lead to di arrest of Pastor Amos Joel Muyiwa, wey admit say im author and circulate di voicenote witout verifying di authenticity.
Dem also arrest one Mulikat Bashiru wey originate di voicenote, police tok.
Cross River State also get dia own share of false security alarm. Tori bin spread on social media wey allege say criminals don enta di state and say police don arrest some bandits for Calabar and Akamkpa local govment area.
Di police for statement clear am say dem no arrest any bandit and security for di state dey kampe.
Same false security alarm ring for Osun, Kwara and oda states of di federation wey di govment don debunk.
Di Nigerian police say deliberate spread of false informate, fake news, misinformation, and disinformation na serious threat to public order, national security, and peaceful coexistence.
Dem say e fit trigger panic, undermine public confidence, scata socio-economic activities, and divert security resources away from genuine emergencies.
Police say sake of dat, dem sama warning say dem go investigate and prosecute according to di law anybodi dem catch dey originate, publish or dey deliberately spread false and inciting information wey fit cause public alarm, disorder, ethnic tension, or violence for di kontri.
Meanwhile, Nigeria Criminal Code Act: Section 59 ban di publication or reproduction of any statement, rumour, or report wey dey likely to cause fear and alarm to di public or disturb di public peace, provided say di pesin know or get reason to believe say di information na fake.
Dis offence carry up to three years of imprisonment.
States wey don step up security
Sake of di security palava wey dey go on for di kontri, state govments for Nigeria don dey take measures to guard dia pipo.
On Thursday, di presidency say Nigeria dey move closer to establish state police, as dem don make progress towards di constitutional framework wey dey required to decentralise police.
Chief of Staff to di President, Femi Gbajabiamila, wey announce dis informate as e dey follow tori pipo tok for di State House, Abuja, afta one consultative meeting on state police wey di presidency organise.
For statement wey tok-tok pesin to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga release, e say deliberations on di proposed state police framework don start several months ago, afta one directive from President Tinubu.
Di president chief of staff explain say di immediate priority na to secure constitutional amendments, while enabling legislation go follow.
Nigeria policing system currently dey controlled by di Nigeria govment through di Nigeria Police Force.
However, growing security challenges don intensify calls for decentralised policing structure.
Earlier, di president bin note say state police dey unavoidable to tackle insecurity, and e urge lawmakers to fast-track related bills.
Meanwhile, pending di approval of state police, di Osun state Govnor Ademola Adeleke say im don repair di Armoured Personnel Carriers wey di previous administration abandon and dem dey fully ready for deployment.