Building collapse kill one pesin, fire burn Makola market and police station during heavy rain same night for Ghana

Published
Read am in 4 mins

One pesin die afta two-story building collapse for Adenta new site for Accra during heavy rain on Wednesday night.

Fire service and oda security agencies rescue four odas wey bin dey trapped under di rubble.

Di four dey receive treatment for di 37 military hospital.

Di Ghana National Fire and Rescue Service (GNFRS) confam say di pesin wey die na female, wey dem carry di bodi put for bodi bag wey di police carry am comot di scene.

Officers say di woman wey die be 38 years wey her name be Margaret.

Residents for di area gada for di scene as emergency responders bin dey cut thru di rubble to rescue trapped victims.

Di National Disaster Management Organisation (Nadmo) tok say dem collaborate wit di security agencies to rescue affected pipo wey dem dey offer support to di odas for di area.

Accra Regional fire officer ACFO II Rashid Kwame Nisawu tok say "pipo wey dey stay around here tok say di pillar of di building dey close to one manhole, wey di structure also bend, wey show say somtin dey wrong wit di building since".

Investigations already begin for dis incident wey happun two months afta 4-storey building inside one school compound for Accra New Town also collapse for 30 March.

Three pipo die for dat incident afta di 14-year-old uncompleted building collapse dat day.

Many areas for Accra flood afta hours of rain

Rain wey last for more dan four hours flood many places for di city.

Water enta pipo dema houses and destroy some properties.

Residents for some areas comot dia houses sake of di water take ova di place wey e reach dia knee and waist level.

Places for Agbogba, Ashongman, Dansoman, Ablekuma, Nanakrom, East Legon Hills, Adenta among odas don flood.

For some roads, drivers dey inside traffic for more than three hours sake of di rains.

Part of Makola market and police barracks catch fire during rain

Di Ghana Police Service confam say di fire enta di Accra Central Police barracks, wey di fire service bin dey dia to quench am.

Inside one statement, di police tok say di Inspector General of police (IGP) and di management board "visit di location to assess di situation and provide support to personnel wey dey affected".

Nobodi die for dis fire, according to di police wey dem bin arrest one suspect wey dey assist wit investigations.

Eyewitnesses tok say dem see smoke during di rain wey dem shout for help.

"I hear pipo dey shout during di rain so I dey try comot wey I see smoke, water also full our compound at dat time, wey I begin to shout for help, one woman tok.

She tok say "by di time I realise, di fire spark wey e begin to burn di houses, bifor di fire service come, now we no get anywia to sleep, all our tins don burn".

Dat same time anoda fire happun for di Makola market for Accra.

One of di tok-tok pipo for di National Fire Service ADO I Alex King Nartey tok say one of di fore officers for di scene of di market fire injure during di process to fight di fire.

"We receive call wey we deploy fire trucks from Parliament and oda stations to di scene wey we try to fight di fire. We gatz secure di oda buildings close to di scene.

"Gas cylinders din dey inside some of di structures so we use foam concentrate to deal wit di fire, but as we dey fight di fire, some traders try to gada wetin dem fit gada, now we control di spread," ADO I Alex King Nartey explain.

Di fire destroy many market shops wey firefighters struggle to put di fire under control.

Traders bin lose dia properties and oda tins dem dey sell for di market.

Di rain and fire dey happun on 3 June, exactly di date wen twin flood and fire disaster for di Kwame Nkrumah circle area kill ova 150 pipo 11 years ago.