Two pipo die for di Kenya protests against US Ebola quarantine centre plan

    • Author, Thomas Mukhwana
    • Role, Africa correspondent
    • Reporting from, Nanyuki
    • Author, Basillioh Rukanga
    • Reporting from, Nairobi
  • Published
  • Read am in 3 mins

Two pipo don die for central Kenyan town of Nanyuki as dem dey protest against US plan to set up Ebola isolation centre for military base wey dey nearby.

Dem kill one of di victims for one area wey dey close to Laikipia Airbase wia dey do demonstration. E die afta dem bring am come town hospital

Di oda pesin die wen soldiers carry am go di hospital.

How e take die no clear, and officials neva tok anytin about am. Police tok-tok pesin tell Reuters say e no dey aware of any death.

For Monday, hundreds of demonstrators march through di streets, dem block roads and burn tyre, while police dey fire tear gas to scatta dem.

Community leader Patrick Wahome tell BBC say one pesin wey die na becos dem shoot am "wen e dey go home afta e close im business".

BBC no fit confam how di second man take die. Both bodies wey dey hospital morgue get bullet wounds - one for chest and di oda for shoulder.

Di town dey calm on Tuesday morning, and heavy security dey for di streets.

Di US plan to setup Ebola treatment facility for Kenya don make pipo dey fear about cross-border infection risks.

Di 50-bed isolation center go get US medics wey go treat US citizens wey dey face di current outbreak for Democratic Republic of Congo.

Kenya neva record any Ebola case so far.

Last Friday, di High Court tok say make dem stop di opening of di center afta one rights group open di case wey alledge say di facility dey pose "grave and imminent risks" to public health.

For di first time wey President William Ruto tok about di issue on Monday night, e defend di plan, e tok say Kenya don "deploy every arsenal" to protect di kontri.

E tell journalists say US govment don ask for Kenya support to deal wit di virus, and don accept, as e dey call for "mutual agreement".

"Wen President [Donald] Trump ask Kenya to support dem wit center for Laikipia Airbase, I tok ok becos na agreement wit friends wey don dey wit Kenya for 30, 40 years," e tok.

E dey urge Kenyans make dem no politicise matta wey dey "so serious" like Ebola, e ask politicians make dem avoid "reckless" tok about am.

"We be responsible govment". We sabi wetin we dey do," e add.

Di High Court on Tuesday don extend di suspension, instructing govment make dem show di details of di proposed Ebola facility.

Military aircraft don dey fly in and out of di airbase as expert tok say dem dey prepare despite di court order.

Kenya doctors' union and govment watchdogs don oppose di plan, tok say e dey risk to expose local population.