You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
UK introduce harder rules wey fit ban sponsorship for international students
UK govment don announce new rules wey fit make some universities lose dia right to employ international students, if too many of dia students dey drop out or no follow visa rules.
UK Home Office for new reforms dem unveil on Thursday, introduce harder sponsorship requirements for higher education institutions.
Under di new plan, authorities outline fresh sponsorship guidelines wey go punish higher institutions wey no employ students properly.
"Di new sponsorship rules go introduce sliding scale of penalties for higher education institutions wey fail to recruit responsibly," di Home Office tok.
Dis move na part of effort to stop visa abuse, as govment dey tighten control on how foreign nationals dey enta and remain for di kontri.
Di announcement come afta new figure show say asylum claims from pipo wey enta di kontri wit work, study and tourist visas go up.
Under di previous administration, di number bin more dan triple, e reach about 37% of all di asylum claims, and foreign students account for di largest share.
Di govment say asylum claims by students don since fall by 30% for 2025, sake of di tough action dem take and dem wan continue wit dat patter.
Sake of dat, di new sponsorship rules go require make:
- Visa refusal rate: must remain below 5% (previously 10%)
- Course enrolment rate: must reach at least 95% (previously 90%). E mean say Universities must also maintain a minimum enrolment rate of 95 per cent, compared to di previous requirement of 90 per cent.
- Course completion rate: must reach at least 90% (previously 85%) - Dis one mean say institutions must now ensure say at least 90% of dia international students successfully complete dia courses. E go up from di previous threshold of 85%.
Di new measures go take effect immediately, as dem don schedule one new traffic light rating system for universities wey dem go introduce from summer 2027.
Universities wey receive di red rating go face restrictions on di number of international students dem fit employ and go dey required to finance a 12-month action plan to fix failing practices