You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigerian teachers protest abduction of schoolchildren and teachers as victims still dey captivity for ova two weeks
Nigeria Union of Teachers for Lagos, Oyo and Ogun states dey protest sake of di abduction of teachers and pupils for Oyo and State.
Dis dey come as teachers for public primary and secondary schools for Oyo State begin strike on Monday 1 June sake of di same issue.
Residents, labour activists and civil society organisations for di three states enta di streets to demand for di release of di victims and also dey ask diauthorities to strengthen efforts to address di worsening security situation for Nigeria.
Gunmen bin kidnap di pupils and teachers on 15, May 2026 afta dem attack Community Grammar School, Baptist Nursery and Primary School, and L.A. Primary School for Esinele and Yawota communities of Oriire Local Govment Area.
You go remember say na di same day gunmen also attack Mussa Central Primary Schools for Askira-Uba Local Govment Area and kidnap more dan 50 schoolchildren.
Parents of di schoolchildren wey give update on di attack on Saturday, 16 May, tok say most of di victims na children from di nursery section of di Schools wey dem believe say dey between two and five years old.
One of di parents wey follow BBC tok, say di jaguda pipo kidnap im six year old daughter, and say im wife dey heartbroken and just dey cry since tori of di incident break.
E add say di kidnappers neva make any contact and dem no get any idea which group dey responsible for di abduction.
One of di schoolteachers also tell BBC say di small children bin don already sidon for dia classrooms wen di attack start.
E say im bin hear gunfire bifor armed men storm di school and begin dey round up children.
Tinubu send delegation to Oyo State
Dis protest dey come afta President Bola Tinubu send im Chief of Staff, Femi Gbajabiamila; di National Security Adviser, Nuhu Ribadu; di Minister of Defence, Christopher Musa; and di Inspector General of Police, Tunji Disu, to Ogbomoso, to visit di place wia di kidnapping bin hapun, and to console di pipo wey dey affected.
Di govnor of Oyo State, Seyi Makinde, also join di presidential delegation to visit di community wia dem again promise di pipo say govment go do evritin for dia power to rescue di students and dia teachers.
One pikin wey dey two years old follow for pipo wey di bandits kidnap, Ribadu describe am as "notin but evil".
"We share for your pains and agonies. Di perpetrators of dis dastardly act dey evil. Di federal govment go make sure say we go bring dis inglorious act to end nationwide," e tok.
Gbajabiamila tok say dis current situation dey really pain President Tinubu and e don direct make security authorities do "whatever e go take" to bring di kidnapped children and dia teachers back home.
"Your pain and anxiety dey understood. By di grace of God, your children go return safely to your arms," e tok.
Defence Minister Musa also announce say di President dey committed to use forest guards and local security groups to help di security agencies to provide security for rural communities.
"Like di Chief of Staff bin tok, President Tinubu don approve di immediate recruitment of 1,000 forest rangers for Oyo State," Musa tok as e promise say dem go also consider oda security requests by di pipo.
As of dis Monday, e don pass two weeks wey di students and dia teachers, including di school principal and di two-year-old pikin, don spend for di forest wit di jaguda pipo.
Di same tin also dey happun for di case of di 50 students wey bandits kidnap for Askira-Uba, Borno State on di same 15 May. Dem still dey for captivity reach now and e kon be like say both di govment and di media no dey too tok about dem.
Dis fit be sake of di killing of one of di teachers wey di bandits bin video and circulate am ontop social media. E also fit be sake of say mass kidnapping of students don dey turn regular tin for di northeastern part of Nigeria wia Borno State dey located.
Na for Borno State di first eva mass kidnapping of school children bin happun for Nigeria, and dat na di Chibok Girls case, wia Boko Haram terrorists bin pack more dan 270 girls from Government Girls Secondary School, Chibok, for April 2004.
Di Nigeria govment later rescue some of di girls in batches, but up till today, more dan 22 years afta, ova 90 of di girls still neva return to dia parents and hope don dey go down on weda dem go eva come back again.