Nigeria release plan to evacuate citizens from South Africa sake of anti-immigration protests

Published
Read am in 5 mins

Nigeria say dem don dey prepare repatriate dia citizens from South Africa as concerns grow ova anti-immigration protests and reported attacks on foreign nationals.

Di tok tok pesin for Nigeria Ministry of Foreign Affairs, Kimiebi Ebienfa, tell di BBC on Friday say screening processes don currently dey go on to determine dose wey wan return home.

"We dey planning to repatriate, we dey do screenings now, but numbers neva dey confam," e say.

E add say na wen dem finish screening bifor dem go sabi di number of pipo wey wan come back to Nigeria as dem neva fix di date for evacuation yet.

"Afta screenings, we go know how many pesin dey willing to come back".

Dis move confam say Nigeria join di list of African kontris wey dey comot dia citizens from South Africa afta anti-immigration attacks.

For Ghana, dem don carry first batch of nearly 300 pipo wey arrive for Accra for 27 May 2026.

Ghana authorities say dem dey overwhelmed by di number of pipo wey dey register for voluntary repatriation from South Africa.

Na ova 1,000 Ghanaians register to comot South Africa as tension dey rise and anti-illegal vigilantes continue to harass and attack foreigners.

Dem accuse African migrants say dem dey involved for criminal activities wey dem dey take all dia jobs

But dis foreigners and dia embassies deny dis claim

Bifor now, Nigeria don issue fresh warning to dia citizens wey dey live for South Africa afta tori of renewed anti-foreigner protests for some parts of di kontri.

Di Nigerians in Diaspora Commission (Nidcom) on Friday, 24 April tok say dem receive reports of demonstrations for several cities wey turn violent, and reports of looting, property damage and injuries full ground.

Di statement from Nidcom dey ask citizens to exercise caution.

Nidcom advise Nigerians to avoid confrontation, stay away from protest areas and closely monitor local media for updates.

Nigeria police also tell citizens for Nigeria say make dem no do dia own retaliation attack back.

"Any attempt to target South African nationals, diplomatic facilities, businesses, or other lawful interests within Nigeria go dey treated as criminal act and dealt wit in accordance wit extant laws," di Nigerian police say.

Second batch of almost 350 Ghanaians arrive from South Africa

About 350 Ghanaians from South Africa don arrive di kontri as part of di second batch of di evacuation process.

Dis dey add to di almost 300 pipo wey arrive on 27 May 2026 on board goment chartered flight.

Ghana authorities begin di exercise as tensions continue to dey rise for South Africa and attacks on foreigners dey increase.

Di second batch also involve almost 350 pipo wey bring di total number of evacuees so far to about 650.

Di fresh batch also go undergo screening and registration process for di Accra International Airport, bifor dem go collect dia packages.

Goment officials and oda pipo from di foreign ministry receive di citizens for di airport on Saturday 6 June.

Anoda batch also dey expected to arrive on Sunday 7 June 2026 - if tins go as planned.

Ghana foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa say di kontri dey use dia contingency budget to fund di evacuation of dia citizens wey dey flee xenophobic attacks.

African kontris wey dey comot dia citizens from South Africa

Tensions don rise for different parts of South Africa in recent weeks, wit anti-migrant demonstrations calling for tougher action against undocumented migrants.

Several African kontris don issue advisories to dia nationals, while odas begin evacuations wit some still planning.

Ghana alreadi repatriate hundreds of dia citizens sake safety concerns, and still dey plan to do more. Some oda kontris dey follow too:

Nigeria plan to comot dia citizens from South Africa dey come as di tok of attack on foreigners still full ground.

Di kontri ministry of foreign affairs say dem go begin arrangement for dose wey wan comot as consultations still dey go on.

Although Nigeria neva get di number of pipo wey dem wan move comot.

Malawi say dem dey prepare similar steps to evacuate dia citizens comot from South Africa.

For statement, Malawi Ministry of Foreign Affairs say dia programme go focus only on citizens wey request assistance.

Di ministry further release details to follow once logistics dey finalised.

Malawi govment provide buses for di border to facilitate di removal of dia citizens.

Mozambique

Earlier dis week authorities say two men from Mozambique dey killed for South Africa Mossel Bay.

Howeva, Mozambican goment say five of dia nationals dey killed "as a direct consequence of xenophobic attacks".

But di police for South Africa no give di motive and investigation dey go on.

Meanwhile, di kontri also dey among dose wey dey plan to evacuate dia citizens comot for South Africa.

One group of about hundred and forty (140) pipo, mostly from Malawi and Mozambique, don return home by bus afta dem live for one community hall for nearly one week inside di town of Kleinmond for di Western Cape.

Mozambique say ova five hundred of dia citizens don alreadi return and more dey set to follow.

Ghana

Ghana plan to send home anoda group afta dem evacuate three hundred last month.

Meanwhile, di second batch of evacuees delay sake of South African authorities neva give flight permit as at Sunday 31 May wen di Ghana govment plan to move dem.

Ghana foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa tok for di sidelines of di Korea-Africa foreign ministers meeting on 1 June say all dey set for di next batch to arrive.