'I marry South African woman, dem dey bully my kids' - Nigerian man share wetin im eye see as protests dey continue

Read am in 5 mins

Wetin start as anti-migrants protest for South Africa don turn violent as many foreign nationals wit legal status for di kontri don begin fear for dia lives.

According to local reports, many businesses owned by foreign nationals don dey close down, even children from multiple nationalities don dey fear to go school as many dey face bullying from dia peers.

Nigerian-South African Peter Odike wey don dey live for South Africa for more dan 20 years tell BBC say im children dey face bully for school from locals sake of di ongoing xenophobic attacks against foreigners.

"So, pipo dey fear, I get three kids, and dem dey bully dem for school. Na me dey even dey comfort dem."

Peter, wey don dey naturalised for South Africa since 2006, tok say many immigrants including im family members dey fear for dia lives.

Di papa of three, wey marry South African woman, dey operate one small shop for Johannesburg, wia e dey sell shoes. E say businesses owned by foreigners don dey close down becos of dis attacks.

Peter tok say even police dey harass immigrants for South Africa evri day despite say dem get dia legal documents.

"Business dey go down, e no dey safe to stay here," Peter tok.

Peter add: "Police dey harass pipo evri day, even wen you get document na problem wit your face. Once you no look like South African na problem for you.

"Some pipo, even wen you show dem paper dem go ask you, 'Why you dey here?' You gatz go back.'"

Anti-migration protest hold for Durban

Thousands of South Africans bin march to di streets of Durban wearing dia different traditional attires wit placards and sticks as dem begin sing and chant to demand for tougher action against illegal immigrants.

As di protest continue, many citizens gada for Mahatma Gandhi Road, wia majority of foreign nationals dey reside for South Africa.

Dis protesters allege say na undocumented foreign nationals dey stay for di area for South Africa and na dem dey sell illegal drugs to young South Africans wey be di major motive behind dia agitation.

Anti-migrant sentiment don gain ground for South Africa as many locals believe say foreigners dey take dia jobs and dem dey benefit from public resources wey suppose go into di hands of di locals.

Meanwhile, President Cyril Ramaphosa don ask South Africans make dem no allow hatred grow towards "fellow Africans".

African kontris react to di xenophobic attacks for South Africa

Di Nigerian, Ghanaian and Kenyan govments don tell dia citizens wey dey live for South Africa to dey cautious and stay safe from di impounding pressure against foreign black immigrants.

On Monday, Nigerian govment bin call for investigation into di deaths of two Nigerians wey die for South Africa and demand for di prosecution of dia killers.

Di govment bin announce di deaths of Kelvin Chidiebere Amaramuiro and Ekpenyong Andrew wey die for South Africa becos of di ongoing crackdown against illegal immigrants for di kontri.

Nigeria govment demand for autopsy and thorough investigation into di deaths and say make di South African govment make dia investigation accessible to di families of di deceased.

Afta dis move, Minister of Foreign Affairs, Bianca Odumegwu-Ojukw tok say dem go evacuate Nigerians from South-Africa.

For April, Ghanaian govment bin summon South Africa Acting High Commissioner to di kontri, Thando Dalamba, to raise formal concerns ova di recent "xenophobic incidents" against Ghanaians.

On Tuesday 5 May, Ghanian govment relocate Emmanuel Akowuah Asamoah, wey dey inside one viral video wey bin show how some anti-foreigners campaigners dey harass am as im dey im shop dey work.

Ghana Foreign Minister Samuel Okudzeto Ablakwa tell Ghanaians wey wish to relocate from South Africa to Ghana say dem need to contact di High Commission and di govment go assist dem to return back to di kontri.

Meanwhile, Kenya High Commission for Pretoria don ask dia citizens wey dey reside for South Africa to "exercise caution and remain vigilant".

Lesotho High Commissioner for Pretoria, also don advise dia citizens wey dey reside for Basotho for South Africa make dem dey veri careful becos of di protests wey dey target foreign nationals for some areas for di kontri.

Di Lesotho govment urge dia nationals to avoid places wey protest dey happun, and limit non-essential travel during dis period of high tension.