You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria warn citizens for South Africa as fresh anti-foreigners protests dey ginger
Nigeria don issue fresh warning to dia citizens wey dey live for South Africa afta tori of renewed anti-foreigner protests for some parts of di kontri.
Di Nigerians in Diaspora Commission (Nidcom) on Friday, 24 April tok say demonstrations for several cities wey include Cape Town, Durban and East London don turn violent, and reports of looting, property damage and injuries full ground.
Di statement from Nidcom dey ask citizens to exercise caution.
Dis warning dey come afta one advisory from di Nigerian Consulate General for Johannesburg, wey cite say intelligence report show say plans don dey for more protests for Gauteng Province between Monday 27 and Wednesday 29 April.
Videos wey dey spread for social media show as some South Africans hold stick dey pursue and beat oda black foreigners, and tell dem to comot for dia kontri .
Authorities say demonstrators dey expected to press di govment ova di presence of foreign nationals, one long-standing and often contentious issue for di kontri kontri.
Nidcom advise Nigerians to avoid confrontation, stay away from protest areas and closely monitor local media for updates.
Di agency also ask business owners to consider temporarily closing dia shops during di period, as dem warn say foreign-owned businesses na target most times during such unrest.
Di statement add say Nigeria diplomatic mission for Johannesburg go dey open and go dey work wit South African security agencies to ensure di safety of dia citizens.
Officials for Abuja, Nigeria capital, say diplomatic engagements also dey go on between di two kontris.
Meanwhile, South Africa Police don condemn di recent violence and intimidation wey dey directed at Ghanaian nationals plus oda foreign nationals for di kontri, as dem say dem don receive instruction to address di issue.
For statement wey di di police issue, dem say dem go find all dose wey dey cause and participate for di attacks, arrest and bring dem bifor di courts.
Di police advise members of di public say acts of xenophobia, violence, looting, or intimidation no go dey tolerated under any circumstances.
South Africa don face repeated waves of xenophobic violence ova di past twenty years, wey frustration ova unemployment dey mostly ginger - oda factors wey dey ginger am na inequality and perceptions say foreign nationals dey take all di jobs or running businesses at di expense of locals.
Major outbreaks for 2008 bin kpai more 60 pipo and displace thousands.
Further attacks for 2015 and 2019 target migrants from across Africa, wey include Nigerians, Zimbabweans and Somalis, wey don lead to diplomatic tensions and reprisals for some kontris.
For Nigeria, anger on top di 2019 attacks bin lead to protests and retaliatory incidents against South African-owned businesses, including outlets wey dey linked to companies like MTN Group and Shoprite Holdings.
Despite repeated assurances from South African authorities, migrant communities still dey worry about dia safety during periods of unrest.
Nigeria latest advisory dey come ahead of Freedom Day on 27 April - one national holiday wey dey mark di first democratic elections - wen tensions previously don rise.