You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin we know about di California hostage situation inside bank wia pipo dey trapped
- Author, Gift Andrew
- Published
- Read am in 3 mins
Police for California don confam say ongoing hostage situation dey happun for Bakersfield area of di state and dem don shutdown di area.
Tori comot on Tuesday, 2 June say one man hold plenti pipo hostage inside Chase Bank building wey dey for Chester Avenue and 17th Street, say di hostage taker carry bomb.
For statement, Bakersfield Police Department say dem receive call about bomb threat, say during investigation dem discova say di man barricade imsef inside di building wit several community members but nobodi don report any injury.
Di statement say police don establish perimeter around di building and oda surrounding businesses to ensure public safety.
According to di statement, some members of di community manage escape from di area on time.
Police don close roads wey lead to di area till further notice.
Meanwhile, police say dem don establish contact wit di hostage taker via phone and dem neva make any arrest.
Police dey tell community pipo make dem stay away from di area and stay safe while dem dey try do peaceful resolution to di case.
As at di time of filling dis tori, police neva name who di hostage taker be, but say through negotiations dem don secure di safe surrender of one of two hostages.
Police tok-tok pesin Sergeant Eric Celedon for video message say wetin happun na bomb threat but dem neva confirm or see any bomb.
Bakersfield na small city for Kern River, north of Los Angeles. E get population of less dan 500,000 pipo.
Tori be say some pipo inside di building dey hide away from di hostage taker.
Police dey work wit FBI to resolve di situation.