Why UK Prime Minister Keir Starmer dey under pressure to resign?

Read am in 6 mins

UK Prime Minister Keir Starmer don insist say e no go resign even as e dey face ogbonge pressure from within im own Labour Party to step aside from im position, afta di party do very badly for recent local elections.

Di number of Labour parliament members wey don call for Starmer to resign or at least make e write timetable to show wen e go resign, don reach 80.

Oga Starmer tok for im cabinet meeting dis Tuesday morning say e take responsibility for di poor election results but e no quit.

"Di past 48 hours don dey destabilising for govment and dat get real economic cost for our kontri and for families. Di Labour Party get process for challenging a leader and dat [process] never dey triggered. Di kontri expect us to get on wit governing, (and) dat na wetin I dey do and wetin we must do as a cabinet," e tok.

For di end of di Tuesday meeting, many of di prime minister inner cabinet members say dem dey support am to carry on wit im work.

"Dis no be game. Dis instability get consequences for pipo lives. Di pipo wey go feel hurt di most na dose wey bin elect us less dan two years ago. We must to unite behind di Prime Minister," Housing Secretary Steve Reed tok for im post on X.

Work and Pensions Secretary Pat McFadden, also tok to tori pipo as e dey comot fro di prime minister office, and e say Starmer go "continue wit im job as e suppose do, as di public go expect am to do. And me I go continue wit mine".

McFadden also add say for di meeting, di prime minister bin get "many statements of support for di job wey e dey do".

However, Health Secretary Wes Streeting, wey pipo dey see as a likely leadership rival to. Starmer, no make any comment to reporters as e comot from Downing Street

Meanwhile, Labour MP, Paulette Hamilton, tok say Starmer don miss im "opportunity to show grace".

"I absolutely feel say he don make mistake. E no dey listen (and) dat na why di public don stop to dey listen to us. Dis no be di way you suppose bring di kontri along wit you. By saying, like a stubborn child, I no go to listen. E no make us look bright for di world stage," she tok.

Labour Party lose almost 1,500 councillor seats for local elections across England, sake of say plenty pipo don turn dia support to di Reform UK Party, and di Green Party also don chop part of Labour Party support for London and oda urban areas.

Voters bin also kick di party out of power for Wales, wia dem bin dey enjoy political dominance for more dan 100 years.

For Scotland too, Labour bin win only 17 out of di 129 seats for di Scottish Parliament, dia worst eva result for parliamentary elections for di kontri.

Prime Minister Keir Starmer for im speech afta di elections admit say di govment bin make some mistakes, but e insist say dem "get di political choices right" and say im go prove di "doubters" wrong and e no go quit.

But di pressure don dey increase say Starmer must step aside as Prime Minister bicos di pipo don show say dem no get confidence for im leadership.

Thomas Rutland, di MP for East Worthing and Shoreham, say: "E dey clear to me say di prime minister don lose authority not just within di Parliamentary Labour Party but across di country and dat e no go fit regain am."

Also, Naushabah Khan, wey dey represent Gillingham and Rainham, say Labour need "clear change of direction now and no game playing".

"I dey call for new leadership so we go fit rebuild trust and deliver di beta future wey di British pipo bin voted for," she tok.

Minister, aides resign

Already one junior minister, Miatta Fahnbulleh, who bin serve as communities minister don resign as she tok say she no longer get confidence for Starmer leadership.

She post for her X handle say she send her letter of resignation to di prime minister dis Tuesday morning, and she call on am to "set timetable for orderly transition".

"Our kontri dey face plenty challenges and pipo dey cry out for di scale of change wey dis require. Di public no believe say you (Starmer) fit lead dis change – and me too no believe," she tok.

Di list of ministerial aides wey bin also resign on Monday included Joe Morris, di Parliamentary Private Secretary (PPS) to Health Secretary Wes Streeting; Melanie Ward, PPS to Deputy Prime Minister David Lammy; Naushabah Khan, PPS to Cabinet Office Minister Darren Jones; and Tom Rutland, PPS to Environment Secretary Emma Reynolds.

Dis political uncertainty dey come just few hours to di State Opening of Parliament, wen King Charles III dey expected to come to di parliament to read out di govment plans for di next parliamentary session.

Di King dey expected to tok about ogbonge issues like di UK allignment wit di European Union, di rising cost of living, immigration, health, housing, crime rate and odas.

Analysts asy di King speech go dey more scrutinised dan usual sake of dis internal wahala wey Keir Starmer dey face wit im Labour Party.

Wetin fit hapun next?

For di Tuesday cabinet meetin, Oga Keir Starmer tok say di Labour Party neva trigger dia process for challenging a leader, and analysts say dat one na challenge wey e dey throw to di rivals for di party make dem publicly challenge him.

For di Labour party rules, vote of no confidence no too get any power. E hapun for 2016 wen Labour MPs bin hold vote of no confidence on top Jeremy Corbyn but e refuse to step down.

Di only way to trigger leadership contest na for 20% of Labour Party MPs to publicly support somebody to challenge Starmer challenger.

As e be now for di parliament, e mean say na 81 Labour MPs dey needed to stand behindanoda person, and so far about 80 MPs don already call on di prime minister to step down, or set out timetable for im departure, but dem neva dey united about who dem want to replace Starmer.

So far, none of Starmer rivals for di Parliament don publicly challenge am.