You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'I pray for one child, I get five' - Woman born quintuplets naturally afta 12 years of trying
- Author, Michael Teferi
- Role, BBC Africa
- Read am in 4 mins
One woman give birth to rare quintuplets for Ethiopia Harari Regional state afta di family try and wait for 12 years for a baby.
Bedriya Adem na di woman wey give birth to five children at once. She say her husband dey ova happi to dey "blessed wit five children at once".
Di 35-year-old deliver four boys and a girl, and all of dem dey in "full health", for di Hiwot Fana Specialised Hospital, according to di hospital.
"I no fit express my happiness for words," di woman tell BBC, as she remember how she dey "filled wit depression and pain" until her prayers finally get ansa.
Hospital medical director Dr Mohammed Nur Abdulahi say di mother and babies remain under medical care for di hospital.
Di babies weigh between 1.3 and 1.4kg (3lb).
How she take born di babies
Di medical doctor tell di BBC say newborns wey weigh more dan a kilogram get di high chance of survival and healthy growth.
Di doctor also tell di BBC say di mother Bedriya bin conceive naturally, witout di aid of in vitro fertilisation (IVF), wey di hospital no dey offer.
End of Di one wey oda users dey read well well
IVF fit increase di chance of multiple births if more dan one embryo fit dey transferred.
Di chance of conceiving quintuplets naturally na about one in 55 million.
Di doctor say di birth na through Caesarean on Tuesday evening.
"She receive regular medical care during her pregnancy and she dey informed say she don conceive more dan one baby. She get full and proper medical assistance throughout," Mohammed say, as e describe how happy she be.
Bedriya say dem don initially tell her say she dey pregnant wit four babies, but wen she give birth, dem see say one more dey dia.
"I pray for just one child, and Allah give me five," she say as she tok about how she feel during her "long wait".
Di first-time mother say her husband already get child from anoda marriage, wey dey live wit dem.
"E use to tell me say having [di oda child] dey enough and say make I no worry, but deep inside I dey suffer - psychologically and emotionally - as di entire village question my inability to give birth," she say.
"Wetin I endure for di past feel like distant dream, one wey I no even wan remember," she add.
"I spend 12 years in pain, hiding myself, and praying constantly for children - at last, Allah hear me."
She say she be subsistence farmer and no dey sure how she go provide for her newly enlarged family.
"But I believe Allah go provide, through di support of my community and di govment."
Dia "five blessings" don get name as Naif, Ammar, Munzir, Nazira, and Ansar.