Black Sherif win Ghana music awards artiste for 2026

Read am in 4 mins

Mohammed Ismail Sherif wey im stage name be Black Sherif aka Blacko don win Ghana Music Awards Artiste of di Year 2026.

Dis be afta im beat five odas for di tense awards show wey happun for di Accra International Conference Centre on Saturday 9 May.

Black Sherif also pick up three oda awards on di night.

Di 'Sacrifice' hitmaker win di ogbonge award for only di second time afta im win Artiste of di Year for 2023.

Blacko beat competition from Medikal wey bin win three awards on di night.

Medikal carry im monster hit song 'Shoulder ft Shatta Wale, Beeztrap' to win Hiplife Song of di Year, Best Collaboration of di Year and Most Popular Song of di Year.

Di 24-year-old im 'Iron Boy' album wey im release for 3 April 2025 win Album of di Year.

Black Sherif im song 'Sacrifice' on top di album also win Afropop Song of di Year.

Anoda song from di album (Where Dem Boys) also win Hiphop Song of di Year.

Di musician also win Song Writer of di Year award.

Afta im pick di ultimate award, Black Sherif tank im fans and family for dia support.

"Make God bless evribodi wey dey listen to my songs, I love you all. I also dedicate dis song to all my fans," Black Sherif tok.

Im promise im fans say more music dey road top dey come.

Oda nominees for di Artiste of di Year category like Wendy Shay win Afrobeats/Afropop Artiste of di Year.

Stonebwoy wey don win Artiste of di Year two times (2015 and 2024), win Reggae/Dancehall Artiste of di Year for di 10th time.

Gospel musician Diana Hamilton win Gospel Artiste of di Year.

Full list of winners

Best Hiplife Song

Medikal Ft. Shatta Wale & Beeztrap KOTM – Shoulder

Best Hiplife/Hip-hop Artiste of di Year

Medikal

Best Highlife Artiste of di Year

Kofi Kinaata

Best Female Vocal Performance of di Year

Enam – Amin

Best Highlife Song of di Year

Kofi Kinaata – It is Finished

Best Traditional Gospel Song

Piesie Esther – Nyame Ye

Best HipHop Song of di Year

Black Sherif – Where Dem Boys

Best Afrobeats Song of di Year

Kojo Blakk Ft Kelvin Boy – Excellent

Best Afropop Song of di Year

Black Sherif – Sacrifice

Best Music Video of di Year

AraTheJay – Put am on God

Best Male Vocal Performance of di Year

Asiama – Akoma

Best Afrobeats/AfroPop Artiste of di Year

Wendy Shay

Best Rap Performance of di Year

Strongman – Mensei Da

Best Highlife Artiste of di Year

Kofi Kinaata

Song Writer of di Year

Black Sherif – Sacrifice

Collaboration of di Year

Medikal Ft Shatta Wale & Beeztrap – Shoulder

Group of di year

Keche

International Collaboration of di Year

Moliy Ft Shenseea, Skillbeng & Silent Addy – Shake it to the Max

Best Urban/Contemporary Gospel Song of di Year

Kofi Owusu Peprah – Big God Afro

Best Reggae/Dancehall Artiste of di Year

Stonebwoy

Best Gospel Artiste of di Year

Diana Hamilton

Album/EP of di Year

Iron Boy – Black Sherif

Most Popular Song of di Year

Medikal Ft Shatta Wale & Beeztrap – Shoulder

Reggae/Dancehall Song of di year

Moliy Ft Shenseea, Skillbeng & Silent Addy – Shake it to the Max

Best New Artiste of di Year

Kojo Blak

Record of the Year

Kwabena Kwabena – Enso Nyame Y3

Audio Engineer of di Year Nominees

Daniel Grull – Enso Nyame Y3

Music for Good

Lali x Lola (Crox it out breast cancer awareness song)

Best African Song

Davido ft Omah Lay - With you

Artiste of di Year

Black Sherif