Wetin be Homeland Security wey Tinubu create for Nigeria security architecture

Read am in 4 mins

Nigeria President Bola Tinubu don appoint a retired Major-General, Adeyinka Famadewa as di special adviser on Homeland Security.

Dis announcement come on Monday 11 May 2026, through di circular signed by di Secretary to di Govment of di Federation, Sen. George Akume.

According to di circular, di appointment of major-general Famadewa dey come for time wen President Tinubu wan strenghten internal security for Nigeria.

Dem say dis appointment na sake of di kai expertise wey Famadewa get for security matter.

"President Bola Tinubu don approve di appointment of Major General Adeyinka A. Famadewa (Rtd) as Special Adviser on Homeland Security, in recognition of im exceptional record of service, strategic expertise, and outstanding contributions to Nigeria national security architecture."

"Di appointment underscore di commitment of di administration of Bola Tinubu to strengthen internal security coordination, enhance intelligence-driven operations, and deepen inter-agency collaboration for addressing emerging security threats across di kontri."

As Homeland Security special adviser, Famadewa go get di responsibility to look into internal security and intelligence for Nigeria.

Although no clarity dey between dis role and dat of di Office of di National Security Adviser (NSA) wey dey responsible for di management and capacity development of di security architecture of di kontri.

Dis new appointment dey come for time wey Nigeria dey face security challenges from bandit attacks to terrorists bombing, and den to di current tori ontop attempted coup.

Wetin be Homeland security adviser role

According to di statement, retired Major General Famadewa get ova 30 years of military and intelligence service across national security strategy, intelligence fusion, counter-terrorism operations, and international security diplomacy.

Di former military man dey well decorated wen e dey active service and im new role dey expected to safeguard Nigeria territorial integrity and national interests.

President Tinubu say e get confidence for di appointment of Major-General Famadewa as e go further help im efforts toward achieving safer and more secured Nigeria.

Oga Tinubu say wit di role of di Homeland Security, Famadewa go help to improve coordination of 'homeland security initiatives, intelligence integration, and proactive risk management."

E say di role na to ensure professionalism wey go help national security for di kontri.

Who be Adeyinka Famadewa

Major-General Famadewa once serve as Principal General Staff Officer to di National Security Adviser for di Office of di National Security Adviser (ONSA) from 2015 to 2021.

Tori be say dey helpful for di role as e help shape Nigeria modern intelligence coordination framework.

Na Famadewa lead di establishment of di Intelligence Fusion Centre (IFC) for Office of di National Security Adviser, wia e create integrated multi-agency intelligence platform.

Di platform bring togeda Defence Intelligence Agency (DIA), National Intelligence Agency (NIA), Department of State Services (DSS), di Nigeria Police Force, and di Armed Forces to improve national threat assessment and strategic response coordination.

Famadewa retire from active military service as Major General Famadewa. Afta dat, e serve as Senior Research Fellow for di Nigerian Army Resource Centre, Abuja.

E get experience for policing, civil-security cooperation, and national security reform.