South Africa President Ramaphosa go address nation ova killings of women

Wia dis foto come from, Presidency
South Africa President Cyril Ramaphosa go on Tuesday, 29 September address im kontri pipo on top steps im administration dey take to tackle gender-based violence and femicide (GBVF).
E go also provide update on investigations into di killings of about 12 women in and around di City of Ekurhuleni, di South Africa govment announce for one post on X.
President Ramaphosa address go dey following series of attacks wey don happun for di kontri in recent weeks.
Just within two months, 12 women don die for circumstances wey police tok say dem no fit rule out di possibility of a serial killer. Dem find di deadi body of most of dem for in and around Ekurhuleni area of Johannesburg.
Di discoveries don cause widespread alarm for Ekurhuleni, particularly around Kempton Park, and e dey come against di backdrop of longstanding concerns about high levels of violence against women for South Africa.
Most of di victims na young women, wey dey dia 20s or 30s, and almost all of dem bin suffer serious violence bifor dia deaths.
These killings don spark fear for South Africa, especially among women wey say dem no feel save for dia kontri anymore.
Minister of Social Development Nokuzola Sisisi Tolashe tok say dem dey treat di issue as a national disaster.
Rights group Amnesty International say one important first step towards protecting South Africa women na to recognise femicide as a separate crime.
"Evri day wey femicide remain unrecognised as a crime na failure to confront di targeted killing of women," Amnesty country director Shenilla Mohamed tok for one statement. "Time don reach to call am wetin e be: Femicide.
Apart from di women murders, gun violence dey happun. Just ova di weekend, twenty-seven pipo die inside two separate mass shootings, few hours apart for South Africa, for di latest gun violence to hit di kontri.
For anoda separate shooting for di early hours of Sunday morning, 27 September, gunmen kpai10 pipo outside one entertainment venue for one township near Cape Town and 11 pipo injure from di attack.
South Africa get one of di highest rates of gender-based violence for di world.
E also get a very high murder rate and though officials statistics no identify di gender of di victims, one recent estimate from di Human Rights Commission show say, on average, dem murder six women evri day between April and June dis year.
While South African police statistics no dey differentiate victims by gender, di South African Human Rights Commission last week say dem don kill 569 women and 1,052 odas don survive attempted murder between April and June dis year



















