Killings of twelve women for South Africa since July - faces of victims as suspected killer of 23-year-old woman kpai

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
- Author, Khanyisile Ngcobo
- Reporting from, Johannesburg
- Published
- Read am in 6 mins
Police for South Africa don discova di bodis of three more women for one area for di east of Johannesburg.
Dis don bring di total number of bodis dem find to 12 in just two months.
Dem find di latest bodis for Ekurhuleni between Saturday and Monday morning, according to local police.
Police don make arrests for three of di cases, wey no be like say dey related to odas. Nevertheless, police don tok say dem no fit rule out di possibility of a serial killer.
Di discoveries don cause widespread alarm for Ekurhuleni, particularly around Kempton Park, and e dey come against di backdrop of longstanding concerns about high levels of violence against women for South Africa.
Hia na di victims so far.
Busisiwe Mahlangu
Case 1
Authorities find di deadi bodi of Busisiwe Mahlangu for Kempton Park on 15 July 2026.
Dis na di first for di string of bodis dem find for Ekurhuleni within a two-month period.
Dem find di 37-year-old naked and her hands dey tied wit cable ties.
Police bin arrest one suspect, dem believe say na her partner, two days afta her murder.
E don dey for police custody since den and dem no link am to di oda deaths wey don follow.
Itumeleng Kekana

Wia dis foto come from, Kekana family
Case 2
Thirty-two-year-old Itumeleng Kekana na di second woman. Dem find her bodi for di same area on 3 August 2026.
Di young mama disappear for July and dem see her bodI badly bruised, partially clothed and dumped for one bridge for Kempton Park.
So far, dem neva make any arrest.
Nomfesane Mjobo
Case 3
Dem discover di deadi body of Nomfesane Mjobo on 26 August, also for Kempton Park.
Na only few details around her death police don release, but like most of di oda victims, dem find her partially or fully naked wit bruises.
Dem neva make any arrest.
Unknown woman
Case 4
Police confam di discovery of one unknown woman for her 20s, on 7 September.
Di woman body bin dey float for one river for Olifantsfontain wen dem see her. She wear only her underwear.
Authorities neva share further details about her death and dem neva arrest any suspect in connection wit her death.
Gracious Nkomo

Wia dis foto come from, South African police
Case 5
Gracious Nkomo na di fifth woman wey dem discover her body, again for Kempton Park area.
Dem find her partially clothed body on 10 September along one road wey dey close to South Africa busiest airport.
Dem neva arrest suspect in connection wit di death of di 28-year-old.
Elizabeth "Tsontso" Moselakgomo

Wia dis foto come from, Thuthuka Zondi/BBC
Case 6
Elizabeth Moselakgomo na di sixth woman dem discover her body, afta one highly publicised nationwide search for her.
Di 38-year-old bin go missing as she go out for her daily run near her home for Kempton Park.
Dem find her body badly bruised and partially clothed on 12 September.
Na di discovery of her body really raise di alarm about di spate of killings. Dem neva make any arrests for her case.
Unidentified woman
Case 7
Police confam di discovery of anoda body just two days afta dem see Moselakgomo body.
Dem find di di body for Olifantsfontein on 14 September, but police withhold her name as dem neva inform her family yet.
Dem neva make any arrests.
Dineo Motapane

Wia dis foto come from, Dineo Motapane
Case 8
Dem discover di body of Dineo Motapane, 38, on 15 September just two days afta pipo last see her alive.
Dem see Motapane battered and partly burned body for di side of di road for Springs, anoda part of Ekurhuleni.
She leave behind one young child. Police neva make any arrest for her case.
Jabulile Ntimba
Case 9
Police discover di body of Jabulile Ntimba, wey dey her 30s, for di side of one road for Boksburg on 17 September. She bin naked and her body dey wrapped in a sheet.
She be di ninth body dem go see for Ekurhuleni.
According to police, e be like say dem kpai Ntimba becos of a possible love triangle.
Dem initially arrest three pipo, two women and one man, for her death, but police later release di man sake of insufficient evidence.
Dem don charge di two women wit premeditated murder and defeating di ends of justice.
Ntombifuthi Nxumalo
Case 10
Police find di body of Ntombifuthi Nxumalo, di 10th body for Ekurhuleni.
Dem discover am for one cemetery for di Tembisa neighbourhood north-east of central Johannesburg on 26 September.
Dem find her naked wit serious head injuries, de also see stones near her body.
Dis don make di police believe say maybe dem stone her death.
Police arrest one 36-year-old man one day afta Nxumalo death, afta e travel go anoda province.
E dey face murder charge.
Unidentified woman
Case 11
Dem find di body of one yet-to-be identified woman for Springs on Sunday, 27 September - di 11th body found for Ekurhuleni.
Na one security company wey dey patrol di area discover di deadi body.
Dem see di woman for one open field. Police neva share further details and dem neva make any arrests.
Boitumelo Gift Mashita
Case 12
Dem shoot and kill Boitumelo Gift Mashita on Monday, 28 September for Tembisa Ekurhuleni.
Di 23-year-old woman bin dey on her way to work wen pesin gun her down and collect her belongings.
Police say dem find her estranged husband, wey dem suspect say dey responsible for her death, dead for inside im motor for Midrand.
Police neva find any link between dis case plus di discovery of di oda bodies.
While dem find most of di bodies for di same area, police bin confam di discovery of anoda body about 39 miles (63 km) away from Ekurhuleni on 20 September.
Na di body of one young woman, dem believe dey her 20s. Dem find her body wrapped inside one duvet for one dam for Soweto, south-west of Johannesburg.
E neva dey clear if her murder get connection wit di ones wey dem see for Ekurhuleni.
President Cyril Ramaphosa tok say di killing of these women plus odas na "stain on our national conscience".
South Africa get one of di highest homicide rates, wit 5,427 pipo murdered between April and June dis year alone.
South African police statistics no dey differentiate victims by gender but di South African Human Rights Commission last week say dem kill 569 women between April and June dis year.
Dis one mean say dem dey kill an average of six women each day.
Police don set up one task team to investigate these murders and dem don offer a reward of 400,000 rand ($24,000; £18,000) for information wey fit lead to arrests.




















