Police discover di deadi body of anoda woman for South Africa

Wia dis foto come from, Getty Images
South African police don discover di deadi body of anoda woman for Ekurhuleni, for Guateng province, east of Johannesburg on Saturday morning, 26 September.
Dis discovery bring to 10, di number of women dem find dead for di area since July. E follow di death of nine oda women wey dem find dia bodies across Ekurhuleni, one major urban area of Johannesburg.
Police for one short post on X tok say; "We discover one woman body for Tembisa South, for di Vusimusi section dis morning," dem no provide further details.
"At dis stage, we fit only confam di discovery of di body. Crime scene management and all di necessary role players currently dey di scene," police add for di post.
Di police no tok if dis body get any link wit di ones wey dem don discover bifor, dem also no provide any informate on who she be, dem however say, investigation dey go on.
Dem find dis 10th body for Tembisa south. Tembisa, na one large township wey dey di north of Kempton Park on di East Rand of Gauteng province. Di same area dem discover di previous bodies.
Most of di women wey dem find bin dey partially clothed and dem get injuries, but police make am clear say dem no fit establish weda na serial killer dey responsible for all di deaths.
Di discovery don spark fear for di area, particularly among women wey say dem no feel safe any longer.
"We dey fear to come out of our houses. We dey fear to go to di shops. We no dey free for di kontri wia we suppose dey safe as women," local resident Bongeka Sebela tell BBC.

















