Nigerian politician children wey dey contest for elective positions for 2027 election

Prominent Nigerian Politician Children wey dey Contest for 2027 Election
    • Author, Muslim Muhammad Yusuf
    • Reporting from, BBC Hausa
  • Published
  • Read am in 7 mins

As Nigeria dey move closer to di 2027 general election, pipo dey pay more attention to how children of some of di kontri prominent politicians dey contest political positions wey dia parents once hold or kontinue from di political influence wey dia families don build.

Among dem na pikin of former presidents, former govnors and former Senate presidents wey dey seek tickets for major political parties to represent dia communities for National Assembly.

Di development don dey cause debate on whether Nigeria politics dey gradually turn family inheritance.

However, some pilo say dem get di same right to contest political office like any oda Nigerian, while critics believe say di increasing number of candidates from established political families show say political power dey gradually gather for di hands of few pipo.

Data wey Independent National Electoral Commission (INEC) release show say 20 children of prominent Nigerian politicians dey contest different positions.

Some don already enter politics and hold public office bifor, while odas dey prepare for dia first election for 2027.

Out of dem, five dey contest Senate seats, while di remaining 15 dey seek Representatives.

So who be these children of prominent politicians wey dey try kontinu from wia dia parents stop?

Children of former Presidents

Three candidates na children of former presidents or vice-presidents.

One among dem dey contest Senate seat, while two dey seek election into House of Representatives.

Iyabo Obasanjo – Ogun

Iyabo Obasanjo

lyabo Obasanjo na daughter of former Nigerian President Olusegun Obasanjo.

She don contest election bifor and once serve as Senator wey represent Ogun Central.

For di 2027 election, she dey again seek di Ogun Central Senate seat under Peoples Democratic Party (PDP).

She lose di govnorship ticket of AIl Progressives Congress (APC) bifor later secure di PDP Senate ticket.

Her emergence come afta serious political battles, as some party members and opponents file complaints to authorities to stop her candidacy.

Yusuf Buhari – Katsina

Yusuf Buhari

Yusuf Buhari na son of late former President Muhammadu Buhari.

Im papa govern Nigeria from 2015 to 2023 under APC.

Yusuf dey contest for House of Representatives seat wey represent Daura, Sandamu and Mai'adua for Katsina State.

E go contest under APC.

Adamu Atiku – Adamawa

Adamu Atiku Abubakar

Na son of former Nigerian Vice-President Atiku Abubakar, wey serve during Olusegun Obasanjo administration.

Im papa don remain one of Nigeria most influential politicians for many years and don contest for president several times under different political parties.

Atiku currently dey contest for president under African Democratic Congress (ADC) for di coming 2027 election.

Adamu Atiku dey seek to represent Ganye/ Jada/Toungo/ Mayo Belwa federal constituency of Adamawa State for House of Representatives under di ruling APC.

Children of former govnors

Most of di candidates for dis category na children former govnors.

At least eight to ten pipo dey try follow dia parents political footsteps for dia states.

Some dey contest Senate seats while most of dem dey seek seats for House of Representatives.

Bello El-Rufai – Kaduna

Bello El-Rufai
Wetin we call dis foto, Bello El-Rufai daga hagu

Bello El-Rufai na son of former Kaduna State governor Nasir El-Rufai.

Presently, e dey represent Kaduna North for House of Representatives afta e defeat di sitting lawmaker for di 2023 election under APC.

Now e dey seek re-election, but under di opposition ADC.

Dis one follow disagreements between am and APC, especially di strained relationship between im papa and di party.

Mustapha Sule Lamido

Mustapha Sule Lamido

Mustapha Sule Lamido na son of former Jigawa State govnor and former Nigerian Foreign Affairs Minister Sule Lamido.

E enter politics for 2019 when e contest for Jigawa Central Senate seat under PDP.

For 2023, Mustapha contest for govnor of Jigawa State under PDP, facing APC candidate Umar Namadi, wey win di election.

For di 2027 election, Mustapha dey again contest for govnor of Jigawa.

For May 2026, PDP endorse am as dia govnorship candidate without opposition.

Chinedum Orji – Abia

Chinedum Orji na son of former Abia State governor Theodore Orji.

E dey contest for House of Representatives seat wey represent Ikwuano, Umuahia North and Umuahia South.

Erhiatake Ibori-Suenu – Delta

Erhiatake lbori-Suenu na daughter of former Delta State govnor James lbori.

She don win election bifor for House of Representatives, wia she dey represent Ethiope East and Ethiope West.

She dey among dos wey dey contest seats for di 2027 National Assembly election.

Olumide Osoba – Ogun

Olumide Osoba na son of former Ogun State governor Olusegun Osoba.

E dey represent Abeokuta North, Odeda and Obafemi-Owode for House of Representatives.

E dey among children of prominent politicians wey dey seek legislative seats for 2027.

Adegboyega Adefarati – Ondo

Adegboyega Adefarati na son of late former Ondo State govnor Adebayo Adefarati.

E dey represent Akoko South-East and Akoko South-West for House of Representatives.

E dey seek re-election for 2027.

Olamiju Alao-Akala – Oyo

Olamiju Alao-Akala na son of late former Oyo State govnor Adebayo Alao-Akala.

Im papa be one of di state most prominent politicians.

E dey contest for House of Representatives seat wey represent Orire, Ogbom oso North and Ogbomoso South.

Children of oda prominent politicians

Abba Dahiru Mangal and Senator Natsha Akpoti and Sadiq Ango Abdullahi
Wetin we call dis foto, Abba Dahiru Mangal (left) da Sanata Natsha Akpoti (center) and Sadiq Ango Abdullahi (right)

Apart from families of former presidents and govnors, some odas come from influential political homes. Among dem na:

Natasha Akpoti-Uduaghan (Kogi State): Daughter of late Jimoh Abdul Akpoti, former member of House of Representatives. She be di current Senator wey represent Kogi Central and she dey seek re-election under PDP.

Sadiq Ango Abdullahi (Kaduna State): Son of prominent politician Ango Abdullahi. E currently dey represent Sabon Gari federal constituency for House of Representatives and dey seek second term.

Abba Dahiru Mangal (Katsina State): Son of prominent businessman and owner of Max Air, Dahiru Barau Mangal. Although im father never hold any major political office, many pipo see am as one of di most influential figures for Katsina politics.

Abba Mangal secure APC ticket for Katsina Central federal constituency, wey cos controversy afta e defeat sitting lawmaker Sani Aliyu Danlami.

Blessing Onuh (Benue State): Daughter of former Sen- ate President David Mark e dey represent 0tukpo/ Ohimini for House of Representatives and dey seek second term.

Gabriella Omosede lgbinedion (Edo State): Daughter of businessman and politician Gabriel lgbinedion. She dey contest for Ovia North-East/Ovia South-West.

Sani lbrahim Tanko (Bauchi State): Son of one prom- inent political figure for Bauchi and e dey contest for Shira/Giade House of Representatives seat.

Sirajo lbrahim Tanko (Bauchi State): E dey contest for Bauchi South Senate seat.

Asuquo Ekpenyong (Cross River State): E dey among children of prominent politicians wey dey contest for Cross River South Senate seat.

Adamu Abubakar (Niger State): E dey seek to represent Chanchaga for House of Representatives from Niger State.

Beni Lar (Plateau State): Daughter of late Solomon Lar, Plateau State first govnor and one major figure for Nigerian politics. She dey contest to represent Langtang North/Langtang South.

Children of Prominent figures wey no secure party tickets

Some children of prominent Nigerians also try contest for political office for 2027 but no succeed.

Some no secure party tickets or withdraw dia ambitions, even though dem play important roles during di primaries.

Below na some dem:

Fahad Dankabo — Kano

Fahad Dankabo

Fahad Muhammad Adamu Dankabo come from di family of late billionaire businessman Alhaji Dankabo, founder of Kabo Air.

E seek APC ticket for Gwarzo/Kabo House of Representatives seat. However, afta di primary election, Abdullahi Muazu Babangandu emerge wit di ticket through consensus arrangement.

Fahad Dankabo later declare support for Babangandu and say e go respect di party decision.

Idris Isa Yuguda — Bauchi

ldris Isa Yuguda, son of former Bauchi State govnor Isa Yuguda, seek APC House of Representatives ticket for Bauchi.

For di APC primary election wey happun for May 2026, Jibrin Abdullahi Sirajo win di ticket wit 13,190 votes, while ldris Isa Yuguda come second wit 4,053 votes.

Rasheed Kashamu — Ogun

Rasheed Kashamu, son of late former Ogun Senator Buruji Kashamu, seek APC House of Representatives ticket for di 2027 election.

However, for di APC primary election wey happun for Ogun State, e score 265 votes, while Joseph Adegbesan secure 18,884 votes and win di party ticket.