Why Ghana new $60m presidential jet dey provoke kontri pipo

Dem park di Ghana presidential jet, wey carry di kontri national colours and coat of arms, for one airport tarmac
Wetin we call dis foto, Di French-made Falcon 6X go replace di old presidential jet, officials tok
    • Author, Wycliffe Muia
  • Published
  • Read am in 5 mins

Ghana govment don defend why dem buy new presidential jet for middle of criticism on top how much e cost, and as many citizens continue to struggle wit di high cost of living.

Di $60m (£46m) French-made Falcon 6X don spark political row, as opposition politicians don accuse President John Mahama administration of misplaced priorities.

But di govment say di purchase dey justified, as dem argue say Ghana improving economy make di aircraft affordable and dem need am to replace one very old presidential jet.

Di controversy dey come as Mahama administration dey try to demonstrate one economic recovery afta years of financial difficulties wey bin force Ghana to seek IMF assistance.

Na French aerospace company Dassault Aviation manufacture di jet and dem deliver di aircraft to di Ghana Air Force on Monday for one reported cost of $61m.

Parliament bin approve di purchase last December as part of one broader programme to modernise Ghana military aviation fleet, which also includes four helicopters from Airbus.

Dem welcome di jet wit water salute on Monday, but im arrival don trigger criticism online and among opposition politicians ova di cost and timing of di purchase.

Wen e dey for opposition, Mahama imsef bin dey against buying a new presidential jet, wey bring about questions about why im administration now don go ahead to buy one.

Opposition MP Samuel Abu Jinapor question di govment priorities, as e say di expenditure come at a time wen many Ghanaians continue to struggle wit di cost of living and youth unemployment still dey very high.

"Wetin dey unacceptable wen you no dey for opposition no fit suddenly bicom acceptable in govment merely becos di pipo wey hold power don change," Jinapor add.

E accuse di governing National Democratic Congress (NDC) of hypocrisy, as e remember how dia senior figures bin strongly oppose proposals for a new presidential aircraft wen dem bin dey for opposition.

Jinapor also call for greater transparency over di procurement process, how dem finance di purchase plus govment justification for di expenses.

Kenneth Adjei wear blue shirt inside luxurious jet
Wetin we call dis foto, Defence Minister Kenneth Adjei bin welcome and inspect di new jet on Monday

Di purchase don also lead to sharp criticism on social media, as some users argue say dem for spend di money on more pressing public needs.

"Dis money fit employ ova 100,000 nurses and 200,000 teachers," one X user post.

But di govment don reject di criticism, as dem say Ghana economic circumstances don change well-well since di NDC bin oppose a similar purchase.

Peter Lanchene Toobu, chairman of parliament defence committee, tok say di party no ever oppose acquiring a presidential jet in principle.

Dia objection, e say, na on timing, becos dem bin wan purchase am wen Ghana bin dey experience severe economic difficulties.

"We bin agree in principle say we need to buy new presidential jet," e tok.

E argue, however, say Ghana no fit justify di expenses at a time wen e dey find $3bn bailout from di IMF.

"Di strength and macroeconomic stability of dis kontri don improve our status as imports don bicom cheaper, and dis na di right time," e add.

Toobu tok say di govment buy di aircraft without borrowing, as dem cite stronger Ghanaian currency and improved economic conditions.

Government tok-tok pesin Kwakye Ofosu also dismiss suggestions wey dey claim say di purchase na misplaced priority.

E point to falling prices of construction materials and lower borrowing costs as evidence of di kontri improved economic situation.

"Wen I bin dey campaign for 2024, and I dey donate cement, e cost 115 cedis (£7.5) per bag. Today, for 80 cedis, you go get one bag of cement," e tell JoyNews.

Di controversy don also extend to di aircraft interior, afta tori spread say e get dedicated bedroom and bathroom.

But Ofosu don dismiss claims say di jet get dat kain luxury facilities, e say di president no get intention of "bathing in di air".

"Certainly, no bathroom dey for di jet. President Mahama no get intention of bathing in di air," Ofosu tok.

E say di jet get reclining seats wey dem fit convert into sleeping arrangements but e deny say e get dedicated bedroom.

Di govment tok say di new jet go replace di 16-year-old Falcon 900EX, wey don suffer continuous maintenance problems, including corrosion and leakages for im fuel tank.

According to report, dem bin ground di older jet for France for several months in 2025 as e dey undergo repairs.

Di Dassault Falcon 6X na one large, long-range business jet wey Dassault Aviation manufacture.

E enta service for November 2023 and e offer 5,500-nautical-mile.

According to di manufacturer, di Falcon 6X set new standard for widebody comfort, e measure up to six feet, six inches in height and eight feet, six inches in width, di 6X na di first ultra-widebody purpose-built business jet for di industry.

E fit carry a maximum of about 12-16 passengers. Di aircraft dey powered by new-generation Pratt & Whitney PW812D engines, wey in addition to outstanding flight safety and performance dey provide improvements in fuel efficiency and carbon emissions.