27 pipo kpai for two separate mass shootings for South Africa

Pipo stand dey look for beside one burnt car
Wetin we call dis foto, Gunmen burn vehicles as dem run from di scene of one mass shooting for one bar near Johannesburg
Published
Read am in 4 mins

Twenty-seven pipo don die inside two separate mass shootings, few hours apart for South Africa, di latest gun violence to hit di kontri.

Eight gunmen kpai seventeen pipo wen dem storm one bar wey dey close to Johannesburg on Saturday evening, 26 September. 15 odas injure from di shooting.

For anoda separate shooting for di early hours of Sunday morning, 27 September, gunmen kpai10 pipo outside one entertainment venue for one township near Cape Town and 11 pipo injure from di attack.

According to di police, dem allege say patrons bin dey drink for inside and outside di joint, wen di suspects arrive and open fire for pipo wey dey outside. Di suspects enta di joint and continue dey shoot at patrons for inside.

Dem don deploy armed security forces go di scene of one mass shooting for Cape Town on Sunday morning
Wetin we call dis foto, Dem don deploy armed security forces go di scene of one mass shooting for Cape Town on Sunday morning

South Africa get one of di highest murder rates for di world and dem don struggle to contain gang-related gun violence in recent years.

Police neva tok if any motive dey for either of di latest attacks.

For Johannesburg, gunmen bin open fire on customers outside di bar bifor dem continue di attack for inside. Dem burn two vehicles bifor dem escape.

Deputy provincial police commissioner Maj Gen Fred Kekana tok say di attack fit be retaliation for one incident wey happun last month, wey lead to di death of one pesin and anoda wounded, according to AFP news agency.

Speaking at di scene, e say police get clear pictures and in some cases names for di suspects.

"Di suspects dey reportedly armed wit AK-47 rifles and pistols. Dem allegedly search some patrons and collect dia cellphones bifor dem escape inside two unidentified motor vehicles," police tok.

Police tok say dem kpai thirteen men and four women and add say di motive neva dey clear.

For Cape Town, five victims bin die for di scene and anoda five pipo die for hospital.

Dem neva make any arrests for any of di case on Sunday morning.

Authorities say dem don launch manhunt to find and arrest di suspects.

Gauteng police say dem don mobilise one team of detectives and oda specialised units to trace and apprehend the suspects.

"Police don open 17 counts of murder, 15 counts of attempted murder and two counts of malicious damage to property."

Illegal weapons full South Africa and gun violence na one constant problem for dem for decades.

Authorities dey record about 60 murders evriday for di kontri of 62 million pipo.

But one recent spate of mass shootings don raise fears say di problem don pass be careful, as authorities don often link di violence to kasala between gangs wey dey engaged in drug trafficking and illegal mining.

For February, President Cyril Ramaphosa bin call organised crime "di most immediate threat to our democracy, our society and our economic development".

Earlier dis year govment deploy military plus police to areas wey get di highest murder rates as part of effort to reduce armed violence.

Fotos from scenes of di mass shootings

Police for di scene of di mass shooting for one bar
Burnt car
Burnt car
Burnt car
Police for di scene of di mass shootings