'Three Nigerians killed in four days' - Nigeria govment react to death of citizens for South Africa

Wia dis foto come from, Ihsaan Haffejee/Anadolu via Getty Images
Nigeria consulate forJohannesburg don allege say three more Nigerians die for South Africa within four days as xenophobic tension kontinue to rise against foreigners for di kontri.
Di Nigeria Consul-General to South-Africa, Ninikanwa Okey-Uche, condemn di killings of Nigerians wey happun less dan one week, between 18 and 21 September.
Earlier in September, Nigeria govment bin warn against xenophobic attacks against Nigerians for South Africa, afta dem kill two Nigerians Bishop Taiwo Michael Fakunle and Mr James Uchechukwu for South.
Nigeria govment tell di South African govment say dem no dey happy at all ova di attacks but di South Africa Independent Police Investigative Directorate (IPID) tok say dem go investigate di matta but dem neva still report dia findings to di public.
How di three Nigerians wey kpai for SA
On Monday, Nigeria consulate for Johannesburg inside dia statement allege say di first victim wey be Kenechukwu Christopher Igwemmadu die as e dey try run from 'police harrasment and brutality for Kenlin Court on Douglas street, Central Business District (CBD), Bloemfontein.'
Nigeria consulate also allege say one 'South African national kill anoda Nigerian Olaniyi Olaleye Olatunde for Spanata Bar and Grills Nights Club for Pretoria 'afta im try stop di South African wey wan carry di club cup comot.'
Naso dis cause gbege, di South African carry gun shoot Olatunde.
"For 18th September 2026, one Nigerian pesin, Kenechukwu Christopher Igwemmadu, allegedly jump to death while e dey run from police harrasment and brutality for Kenlin Court on Douglas street, Central Business District (CBD), Bloemfontein," di statement tok.
"Di incident start wen di deceased, wey dey work as Security Guard for di Club for Summer Event Centre for Mamelodi, try stop one South African customer wey wan carry cup wey belong to di club comot."
"Dis result in gbege and di South African bring out im gun and shoot Olatunde for im lower body, e suffer serious injury and e begin bleed heavily."
Nigerian consulate also demand for justices ova di death of two Nigerians wey mobs by South African politician and content creator (Sizok'thola team), Xolani Khumalo kpai.
'But authorities for South Africa neva make any arrest.'
Also anoda Nigerian, Christian Hillary Nnaemeka die afta mobs alledgedly by Sizok'thola team, wey Xolani Khumalo dey lead, gada to torture and 'kill di Nigerian man.'
"Di crew arrest am, beat am and torture am bifor e try to run away by jumping ova di fence. Afta dat, e collapse from di injury and tiredness, wen dem rush am go hospital, dem declare am dead wen e reach dia."
"You go rememba say on 9th February 2026, anoda Nigeria guy, Emeka Clement Uzor, Xolani Khumalo reality TV crew shoot am for Windsor East, Randburg. Yet, no arrest don happun and Xolani KHUMALO dey run for election to be di Mayor of Ekurhuleni."
September 30 deadline for undocumented migrants for South Africa
Dis latest Nigeria reaction dey come days bifor 30 September deadline wey anti-migrant groups give illegal migrants to go back to dia own kontris.
Skip content and continue reading
US announce new visa restriction policy for pipo wey dey engage in birth tourism and odas
24th September 2026
FBI begin investigation afta claims say hackers tiff details of all dia agents
25th September 2026
Police share update ontop woman wey allegedly use sex toys on daughter for livestream video
24th September 2026
End of content
Dem bin set similar deadline for 30 June. Thousands of pipo bin take part for di anti-immigration protests around di kontri, wey result in some incidents of violence and looting. Police say about 900 pipo bin chop arrest, mostly for immigration-related offences and looting.
South African authorities don stress say immigration enforcement na di responsibility of di govment and dem cut warning against vigilantism and attacks on foreign nationals.
Nigeria no be di only kontri wey dey help dia citizens to leave South Africa as Malawi say dem don bring home more dan 38,000 citizens between June and early July, while Zimbabwe don report di return of more dan 21,000 pipo.
Di Nigerian govment dey ask South Africa to act on dis matta and arrest all di pipo wey get hand for dis killings.
Cyril Ramaphosa tok on xenophobic attacks for South Africa

Wia dis foto come from, Jemal Countess/Getty Images for Global Citizen
South African president, Cyril Ramaphosa don tok say South Africa no suppose dey defined by xenophobia and intolerance.
Ramaphosa tok say e dey irresponsible for any South-Africa to dey make "inflammatory statements" wey go fuel social tensions among foreign nationals.
But e also add say any migration wey go happun for South Africa gatz happun within di law and dose wey wan live for di kontri must respect di law.
"At di same time, migration must take place within di law. Govment get responsibility to manage our borders effectively, and everybody wey dey live for South Africa suppose respect our laws," Ramaphosa tok.



















