You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Family of Alexx Ekubo release burial arrangements for late actor
Di family of late actor Alexx Ekubo don release im burial arrangements.
Alexx die on Monday, 11 May at di age of 40, and many of im colleagues and fans bin pay tribute to di talented actor.
For di statement wey dem share on di actor official Instagram page, di family list di burial arrangements and also tank di actor fans for dia love and prayers, among oda tins.
"Wit profound sorrow, yet gratitude to God for a life so beautifully lived and deeply impactful, we officially announce di funeral arrangements of our beloved husband, son, brother, friend, and colleague, Alexx Ekubo-Okwaraeke.
"Di overwhelming outpouring of love, prayers, messages, visits, calls, support, and strength shown to di family during dis painful period don dey truly humbling. Words no fit fully express our gratitude. Alexx bin dey deeply loved, and your kindness continue to remind us say im light, compassion, faith, and impact on so many lives no go eva dey forgotten," di family tok.
According to di family, even though im death come too soon, Alexx bin live life wey dey marked by love, warmth, generosity, laughter, and unwavering devotion to God and di pipo e bin cherish.
"Im presence bin fill rooms, lift hearts, and create memories wey go remain wit us forever.
"We warmly invite family, friends, colleagues, fans, and well wishers to join us as we honor and celebrate im beautiful life, enduring legacy, and di precious memories e bin give us all," di statement tok.
"Please continue to keep Alexx, im wife, and di entire family for your prayers during dis difficult time."
Burial arrangements
Alexx Ekubo service of songs go happun on Wednesday, 10 June 2026 for di Monarch Event Centre for Lekki, Lagos by 4pm to 6pm.
Dress code na white, according to di family.
Di wake keep go happun on Wednesday, 17 June 2026 for 7 Ekubo-Okwaraeke Avenue, Aziukwukwa, Ujari Village, Arochukwu, Abia State, southeast Nigeria.
Alexx funeral service go happun on Thursday, 18 June 2026 for Mary Slessor School, Amanagwu Village, Arochukwu, Abia State.
Di late actor interment go happun on Thursday, 18 June 2026 for 7 Ekubo-Okwaraeke Avenue, Aziukwukwa, Ujari Village, Arochukwu, Abia State.
According to di family, reception go follow immediately afta di interment for Mary Slessor School, Amanagwu Village, Arochukwu, Abia State. Dem add say di dress code na white.
Who be Alexx Ekubo
According to im bio ontop im official website, dem born Alexx Ekubo for April 10, 1986 for Port Harcourt, Rivers State, south-south Nigeria.
E bin train as lawyer for di University of Calabar, but na inside acting e really shine and later see fame.
Alexx bin win Best Supporting actor for di 2013 Best of Nollywood Awards ontop im role inside di feem Weekend Getaway.
For 2018, e gbab Special Recognition Award from di Nigerian First Lady say dem dey torchlight im contribution to di development of di Nigerian Entertainment Industry.
For 2020, Alexx bin dey inducted into di MIPAD/United Nations (Most Influential People of African Descent) Top 100 under 40 years Hall of Fame.
Alexx bin reveal anoda of im achievement as di Governing Council of the Institut Supérieur de Communication et de Gestion (ISCG UNIVERSITY) confer am wit Doctorate (Honorary) Degree in Arts & Culture for 2021.
E bin also collect di Nigerian National Award of Excellence wey im bin get for im charity work as di Global Social Giving Actor of di Year.
Although im first major role as actor na Ladies Men.
As actor, Alexx get 116 credits for im feem role.
Di latest feem wey im feature inside come out for February dis year wey dem call Adanne.
Oda feems na Áfàméfùnà: An Nwa Boi Story, A Sunday Affair, Hire a Woman, Omo Ghetto - The Saga, among odas.
Di 40-year-old actor don collect nine awards wey im don collect ova di course of im career.
E bin collect di Black Entertainment Film, Fashion, Television, & Arts Award, London (BEFFTA) for Nollywood Rising Star and di Screen Nation Film & TV Award (London) for Favourite Male African International Emerging Screen Talent for 2014.
For 2015, e collect di Nigerian Teen Choice Award for Outstanding TV Personality.
For 2016, e bag Best Actor of di year from Best of Nollywood and Model Actor of di Year from di Nigerian Model Achievers Award.
For 2022, e win Best Lead actor for di Best of Nollywood and di Best Actor of di Year from di Toronto International Nollywood Film Festival.
For 2024, e bin dey nominated for AMVCA for Best Supporting Actor for im role inside di feem, Áfàméfùnà.