Tinubu receive Certificate of Return afta e win APC presidential primaries

Published
Read am in 5 mins

Nigeria President Bola Tinubu don collect im Certificate of Return on Sunday afta im win di All Progressives Congress (APC) presidential primaries.

Na APC National Chairman, Professor Nentawe Yilwatda present di Certificate of Return to President Tinubu for di International Conference Centre, Abuja.

Dis dey come afta Oga Tinubu defeat im only opponent for di primaries wey be Stanley Osifo on Saturday.

Di Chairman of di APC Presidential Primaries Election Committee, Pius Anyim, say President Tinubu receive total number of 10,999,162 votes, while im only challenger Osifo receive total of 16,503 votes.

APC bin do dia 2026 presidential primary elections across di kontri 8,809 wards for all 774 local govment areas of di kontri.

Na some APC govnors serve as collation officers.

Tori be say Osifo wey come from Edo State no get any vote.

"Mr. President, di election don dey collated, di results don dey computed, and I fit say on behalf of di committee say di following na di records of di elections.

"Mr President, across di kontri, total number of 12,643,306 registered voters bin dey registered for our party.

"Mr. President, for di purpose of dis election, 11,069,756 voters bin dey accredited. Mr President, afta di accreditation, 11,015,665 voters cast dia votes, and afta we complete di votes, I dey delighted to announce, on behalf of di committee, say di aspirants receive vote as follows: President Bola Ahmed Tinubu, GCFR, receive total number of 10,999,162 votes. Mr Stanley Osifo receive total of 16,503 votes," e tok.

Anyim declare President Tinubu winner of di primaries and return am as di presidential candidate of di APC for di 2027 general elections.

Rivers/Bayelsa states

For Rivers State, Tinubu get 280,468 votes, while Osifo get zero votes across di 23 local govment areas of di state, according to Govnor Siminalayi Fubara of di state.

For Bayelsa State, Tinubu poll 277,192 votes across di 105 wards for di eight local govment areas of di state.

Bayelsa State Govnor Douye Diri, wey bin serve as di state Coordinator/Collation Officer for di presidential primaries declare di results for di collation centre for di Chief DSP Alamieyeseigha Memorial Banquet Hall, Yenagoa.

Edo State

For Edo State Tinubu, get 131,096 votes, while Osifo get one vote during di election for di 192 wards for di state.

Govnor Monday Okpebholo, wey be di returning officer for di primaries for di state, say di exercise bin dey peaceful and transparent.

Abia State

For Abia State, na for di state party headquarters for Umuahia dem announce di results.

Di Collation Officer na di Deputy Speaker of di House of Representatives, Honourable Benjamin Kalu.

Im say President Tinubu score 161,005 votes against Osifo wey manage get 1, 002 votes across di 184 electoral wards for di 17 local govment areas of di state.

Delta State

For Delta State, dem announce di result for Asaba and na di govnor wey be di Coordinator/Returning Officer of di APC Presidential Primary Election, Honourable Sheriff Oborevwori, announce di results.

Govnor Oborevwori say President Tinubu get 407,646 votes, and im defeat di only challenger, Osifo, wey get zero votes.

Kogi State

For Kogi State, Tinubu get total of 197,370 votes.

Di Returning Officer for di APC presidential primaries for di state, Govnor Usman Ododo, say na 224,166 registered voters dem get.

Dem accredit 197,370 and 197,370 votes cast.

Some oda results

For Gombe, Govnor Muhammadu Yahaya of di state say APC deliver evri vote to Tinubu during di presidential primaries wey happun across di 11 LGAs.

Yahaya say Tinubu get 450,516 votes while Osifo get zero vote. E say di state get 550,516 registered APC members.

For Zamfara State, President Tinubu get 321,579 votes to emerge as di winner.

Di Chief Returning Officer for di APC Presidential Primaries for Zamfara, Govnor Dauda Lawal, announce say Tinubu win majority of di votes. E get total of 321,579 votes, while im opponent, Osifo, score 42 votes.

For Osun, Tinubu sweep di polls wit 100,880 votes for di primary. Adegboyega Oyetola, minister of Marine and Blue Economy, na im serve as di collation officer.

For Ebonyi, Oga Tinubu win all 207,579 valid votes cast across di 13 local govment areas, while im rival get zero vote.

Francis Nwifuru, govnor of Ebonyi and collation officer for di state, say voting happun di same time across 171 wards and 13 local govment areas, wia di party get 215,490 members.

For Kwara, Tinubu also wipe Osifo. E poll 310,990 votes while Osifo no get any vote.

Abdulrahman AbdulRazaq, wey announce di results, say na total of 457,374 party members register, while dem accredit 310,990 members wey participate for di voting process across di state.

For Bayelsa, Tinubu gada 277,192 votes to defeat Osifo, wey manage get only five votes, according to Doriel Nduwi, di collation officer.

For Kaduna wia Govnor Uba Sani monitor di primaries across di 255 political wards for di 23 local govment areas, im tok say party members come out well-well to vote as dem agree to make Tinubu dia presidential candidate.

For Sokoto State, di collation officer and Govnor Ahmed Aliyu of di state announce say Tinubu get 301,000 votes, while Osifo get zero vote.

Meanwhile, APC bin hold primaries for state assembly tickets, House of Representatives and Senate bifor dem hold for presidential ticket.