You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Alexx Ekubo family reveal wetin kpai di actor and wia e die
Family of Nigerian actor Alexx Ekubo don reveal say di actor die of metastatic kidney cancer.
Dem make di informate on di actor official Instagram page on Wednesday, 13 May, wia dem officially announce im passing.
Alexx die on Monday, 11 May at di age of 40 and many of im colleagues and fans still dey pay tribute to di talented actor.
"Na wit profound sadness we announce di passing of our beloved Husband, Son, Brother, and Friend, Alexx Ikenna Ekubo-Okwaraeke
"Afta brief but courageous battle, Alexx pass away for Evercare Hospital due to complications wey arise from advanced metastatic kidney cancer," di family tok.
Di family say throughout dis difficult journey, Ekubo bear im pain wit remarkable strength, unwavering faith, and enduring hope, as e believe say one day im go share im testimony wit di world.
"During dis deeply painful time, we humbly ask for privacy and prayers for di peaceful repose of im soul, and for all wey dey mourn dis immense loss," di family tok.
Di family also say further details about im funeral arrangements and oda family matters go dey communicated in due course.
"We sincerely tank evrione for di love, support, prayers, and understanding wey dey extended to di family throughout dis period."
Wetin be metastatic kidney cancer?
Wen cancer develop for di kidneys and spread to oda parts of di bodi, e dey known as metastatic kidney cancer - no mata wia di cancerous cells end up, according to Moffitt Cancer Center.
For instance, cancer wey spread from di kidneys to di lungs still dey considered to be kidney cancer and dem dey treat am accordingly.
Certain types of kidney cancer fit spread dan odas. High-grade kidney cancer dey involve abnormal cells wey dey more likely to invade surrounding healthy tissues dan low-grade kidney cancer cells. However, low-grade kidney cancer fit still spread. Dis na why prompt treatment always dey important.
How kidney cancer dey spread
As di tumour dey grow, e dey spread into fat or major blood vessels around di kidney. E fit also creep into di adrenal gland, wey dey sit right on top of di organ, according to WebMD.
From dia, e fit spread farther through your:
Blood. Cancer cells wey get into blood vessel fit travel to many bodi parts through your veins and arteries.
Lymph system. Dis na network wey dey run throughout your bodi, much like your blood vessels. E dey help you fight disease. But cancer cells wey get into lymph nodes fit enta oda organs.
Kidney cancer most often dey spread to di lungs and bones, but e fit also go to di brain, liver, ovaries, and testicles.
Main symptoms of kidney cancer
Often, obvious symptoms of kidney cancer no dey. Dem dey usually diagnose am wen dem dey do test for somtin else, according to NHS.
Wen symptoms dey, e fit include:
- Blood for your urine
- Lump or swelling for your back, under your ribs, or for your neck
- Pain between your ribs and waist wey no dey go away
- Loss of appetite or losing weight witout trying to
- Feeling tired or loss of energy
- High temperature wey no dey go away
- Sweating a lot, including for night
Treating metastatic kidney cancer
Wen treating metastatic kidney cancer, oncologists dey take several factors into consideration to determine weda surgery na potential treatment option, or if treatments wey target cells throughout di entire bodi go dey more appropriate.
Dem also also need to consider wia, specifically, di cancer don spread and di size of di primary tumour.
While certain treatments fit no dey recommended if di cancer don spread, more metastatic kidney cancer treatment options don dey available dan eva bifor.
For instance, drugs wey dey block di formation of new blood vessels (anti-angiogenic drugs) fit help slow down di process of metastasis.
Oda drugs fit block certain enzymes wey dey promote cancer growth. Dis and oda advances don help improve survival rates for patients wit metastatic kidney cancer.
Who be Alexx Ekubo
According to im bio ontop im official website, dem born Alexx Ekubo for April 10, 1986 for Port Harcourt, Rivers State, south-south Nigeria.
E bin train as lawyer for di University of Calabar, but na inside acting e really shine and later see fame.
Alexx bin win Best Supporting actor for di 2013 Best of Nollywood Awards ontop im role inside di feem Weekend Getaway.
For 2018, e gbab Special Recognition Award from di Nigerian First Lady say dem dey torchlight im contribution to di development of di Nigerian Entertainment Industry.
For 2020, Alexx bin dey inducted into di MIPAD/United Nations (Most Influential People of African Descent) Top 100 under 40 years Hall of Fame.
Alexx bin reveal anoda of im achievement as di Governing Council of the Institut Supérieur de Communication et de Gestion (ISCG UNIVERSITY) confer am wit Doctorate (Honorary) Degree in Arts & Culture for 2021.
E bin also collect di Nigerian National Award of Excellence wey im bin get for im charity work as di Global Social Giving Actor of di Year.
Although im first major role as actor na Ladies Men.
As actor, Alexx get 116 credits for im feem role.
Di latest feem wey im feature inside come out for February dis year wey dem call Adanne.
Oda feems na Áfàméfùnà: An Nwa Boi Story, A Sunday Affair, Hire a Woman, Omo Ghetto - The Saga, among odas.
Di 40-year-old actor don collect nine awards wey im don collect ova di course of im career.
E bin collect di Black Entertainment Film, Fashion, Television, & Arts Award, London (BEFFTA) for Nollywood Rising Star and di Screen Nation Film & TV Award (London) for Favourite Male African International Emerging Screen Talent for 2014.
For 2015, e collect di Nigerian Teen Choice Award for Outstanding TV Personality.
For 2016, e bag Best Actor of di year from Best of Nollywood and Model Actor of di Year from di Nigerian Model Achievers Award.
For 2022, e win Best Lead actor for di Best of Nollywood and di Best Actor of di Year from di Toronto International Nollywood Film Festival.
For 2024, e bin dey nominated for AMVCA for Best Supporting Actor for im role inside di feem, Áfàméfùnà.