Who win ADC presidential ticket?

Published
Read am in 4 mins

Di African Democratic Congress (ADC) don postpone di collation of dia presidential primary election results.

Chairman of di Presidential Primary Election Committee, Chief Ikechi Emenike, say di postponement na to allow party members wey be Muslims to celebrate sallah, Eid-el-Kabir.

"We dey postpone di collation to allow our brothers and sisters celebrate Sallah, participate for dia religious activity and to enable returning officers wey get flight challenges to arrive Abuja later today," Emenike tok on Tuesday.

Emenike say, collation for di states wey dey remain go start around 8 p.m on Wednesday night.

ADC start collation of results from dia Presidential Primary Election wey go decide dia candidate for di 2027 General Elections on Tuesday.

Amaechi wey be former govnor of Rivers State and ex-chairman of di Nigeria Governors' Forum, former Vice-President, Atiku Abubakar and businessman Hayatu-Deen na di ADC aspirants.

Meanwhile Atiku Abubakar dey lead di polls wit results wey dem don collate so far from states while Rotimi Amaechi don reject di outcome of di presidential primary election.

Im allege say dem no allow pipo vote during di exercise on Monday. For verified X handle im tok on Tuesday say mago-mago dey.

"Following reports of widespread voter disenfranchisement for most parts of di kontri during di African Democratic Congress (ADC) Presidential Primaries yesterday (Monday) I unequivocally reject di concocted results being announced," im write.

ADC Presidential Primary Results from States

Local media report say returning officers for 24 states bin don collation and announce results, na 12 states bin remian bifor dem postpone am.

Di states Borno, Kebbi, Anambra, Abia, Ekiti, Ondo, Gombe, Oyo, Imo, Yobe, Nasarawa, Enugu, Benue, Osun, Adamawa, Kogi, Kano, Akwa Ibom, Ebonyi , Niger, Plateau, Sokoto, Taraba Zamfara and di FCT.

According to reports, di former vice president don win for Gombe, Abia, Ebonyi, Sokoto, and Zamfara states and more

Zamfara State

Oga Musa say Atiku get 60,500 votes to defeat Oga Hayatu-deen, wey score 446 votes, and Oga Amaechi, wey secure 191 votes.

Yobe State

For Yobe state, di former vice president gada 44,841 to defeat im challengers for di primary wey hold across di 178 political wards for di 17 local government areas.

Chairperson of di electoral committee, Hajiya Ma'am Kyari, say Amaechi get 300 votes, while Hayatu Deen gada 365 votes.

Sokoto State

Atiku also win di presidential primary for Sokoto State by a wide margin.

Di Chief Collation Officer, Aminu Abubakar, say e secure 68,823 votes across di 23 local government areas.

Oga Abubakar say dem cast 69,434 during di exercise. Di former Rivers governor, Rotimi Amaechi, get 292 votes and Muhammad Hayatu-deen secure 319 votes.

Gombe State

For Gombe State, results wey di Returning Officer, Prof. David Agbu announce show say Atiku gada 139,334 votes. Amaechi get 1,150 votes, while Hayatu-Deen secure 464 votes.

Atiku also top di poll for Abia State, e receive 25,153 votes ahead of Amaechi, wey secure 18,339 votes. Hayatu-Deen receive 3,264 votes.

Ebonyi State

For Ebonyi State, di result wey di ADC National Vice Chairman (Diaspora), Fred Onwe announce show say Atiku record 15,300 votes, while Amaechi get 2,200 votes and Hayatu-Deen record 200 votes.

Abia State

Report also Atiku win di poll for Abia State, afta e pack 25,153 votes ahead of Amaechi, who scored 18,339 votes. Hayatu-Deen received 3,264 votes.

Edo State

Atiku Abubakar win di presidential primary of di African Democratic Congress for Edo State. Im beat former Minister of Transportation, Rotimi Amaechi, and businessman Alhaji Muhammed Hayatu-Deen im rivals.

Di Chairman and Returning Officer of di party Primary Election Committee for Edo State, Dr Mabel Adimkwu, say Atiku get 17,729 votes to emerge winner.

Amaechi scored 10,116 votes, while Hayatu-Deen polled 1,906 votes. Di party for Edo State get a total of 32,263 registered voters.

Kebbi State

Atiku get 65,523 votes to defeat Amaechi, wey scored 5,931 votes, while Hayatu-Deen secured 454 votes.

Anambra State

Atiku score 58,566 votes ahead of Amaechi wey get 17,085 votes and Hayatu-Deen's 7,861 votes.

Ekiti State

Atiku get 18,395 votes, e defeat Amaechi, wey record 1,574 votes, while Hayatu-Deen secured 149 votes.