You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Muslims around di world dey celebrate Eid Mubarak
Muslims around di world dey celebrate Eid two times evri year, and Eid al-Adha (Eid-Mubarak) na di second of di two feasts.
E dey happun just over two months afta Eid al-Fitr, and na im be di holier of di two festivals.
Eid al-Adha dey start for di 10th day of Dhu al-Hijjah, wey be di final month for di Islamic Calendar.
E dey take place during Hajj, di Muslim pilgrimage to Mecca for Saudi Arabia.
Eid al-Adha dey last between three to four days. Di date of di festival dey change every year becos Islamic calendar dey based on di moon.
Wetin be Eid-al-Adha (Eid Mubarak)?
Eid al-Adha, wey mean 'festival of sacrifice', na one of di most important festivals for di Muslim calendar.
Di festival na in memory of di story of prophet Ibrahim, wey willing obey Allah wen e ask am to sacrifice im pikin.
Muslims believe say Allah stop Ibrahim bifor di sacrifice happun and provide sheep make im sacrifice instead.
How dem dey celebrate Eid-al-Adha (Eid Mubarak)?
Muslims always start di celebration wit special prayers for mosques on di morning of Eid. Dem go wear fine cloths and thank Allah for all di blessings wey dem don receive.
E dey normal to wish each oda Eid Mubarak - wey mean "blessed Eid."
Children dey receive gifts and na also time for dem to visit family and friends.
Many Muslims dey mark Eid al-Adha by feasting on animals like goat, lamb, cow or camel. Some families dey do dis, while odas dey donate money to trusted charities wey go arrange di sacrifice and share di meat for dem.
Traditionally dem dey donate large part of di meat to pipo wey need am. Dem dey call dis practice Qurbani, or simply Eid sacrifice. Muslims go still give money to charity so that oda Muslims wey no too get money go fit celebrate Eid too.
Tinubu, Akpabio and odas political leaders celebrate Eid Mubarak wit Muslims
President Bola Tinubu, Senate President Godswill Akpabio, and oda statesmen don urge Nigerians make dem embrace unity, selflessness, and compassion as Muslims dey celebrate Eid-al-Adha (Eid Mubarak).
Inside one statement by di president, e tok say di reforms by im govment dey necessary to build stronger and more prosperous Nigeria for future generations.
Tinubu wish Muslim faithful for Nigeria and worldwide, glorious celebration
E tok say di sacrifices by im adminstration for di past three years don bring stable economy and now Nigeria na preferred location for investment.
"Just as sacrifice dey bring reward, I dey happy say all di sacrifices and efforts we don make for di past three years don yield more stable economy, e don turn our kontri to preferred location for investment wey drive job creation and economic growth," Tinubu tok.
Di president also tok about di high level of insecurity for some parts of di kontri adding dat despite di fight againt insurgence by di Nigeria army dem still dey attack some community.
"I assure you: we no abandon or forgot you. We go defeat all di evil forces," di president tok.
Also, Godswill Akpabio, senate presiudent call for unity, sacrifice, and national renewal as Muslims celebrate Eid Mubarak.
Akpabio also send best wishes to President Bola Ahmed Tinubu, Vice-President Kashim Shettima, and all di Muslim faithfuls across Nigeria.
Inside one statement on Tuesday, tok-tok pesin to di senate president, Eseme Eyiboh, tok say dis occasion dey call for prayers and reflection on di theme of sacrifice.
"Dis holy occasion dey remind us of Prophet Ibrahim faith, obedience, and im willingness to sacrifice for Almighty Allah. Dis virtues of devotion, selflessness, and submission to di divine will na values wey our nation need desperately today," e tok.
Di Senate President urge Nigerians make dem use dis period for sober reflection and serious prayers for di kontri, especially for di troops wey dey battle insecurity and farmers wey dey suffer from violence.
Akpabio still urge citizens make dem remain patient and hopeful, as di sacrificesn under dis current adminstration go "ultimately yield positive results."
Former vice-president, Atiku Abubakar tok say leadership for Nigeria don turn to status symbol becos leaders dey far from di responsibilities wey dey dia shoulders.
Atiku tok say Eid-el-Kabir na remarkable moment wey dey remind Muslims faithfuls say of di absolute authority of Allah.
"Dis celebration na to specifically call di conscience of leaders to dia duties to always ensure say di interests of di pipo remain paramount for dia obligations," Atiku tok.
"I dey pray say di spirit of sacrifice, faith, and compassion wey di Eid festival dey show go inspire all Nigerians towards national renewal and our purposeful." leadership"