You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
South Africa crash out of World Cup afta dramatic last-minute goal vs Canada for round of 32
South Africa comot di 2026 World Cup for di round of 32 afta dia dramatic late 1-0 defeat to Canada on Sunday.
Bafana Bafana already make history wen dem qualify for di knockout stage of di competition for di first time.
But di rainbow kontri bin try to go one step more to qualify for di R16 but dem suffer late defeat.
One cracking goal by di Canada captain Stephen Eustáquio for di 92nd minute sink di hearts of di ova 65 million pipo for South Africa.
Di team bin dey try to carry di game enta extra time as both teams no fit find di net for 90 minutes.
But di Canada captain get oda ideas - im chest one headed clearance from South Africa in front of dia box, wey im smash into di far corner.
Goalkeeper Ronwen Williams no fit catch di ball; na so di Bafana Bafana defenders bin sink to di ground afta di goal.
For di oda side, Canada players run to dia coach and di bench to celebrate.
Referee bin add one more minute to di five added minutes sake of di celebration, but South Africa no fit find di equaliser.
Dat na how di game end. Canada dominate di game wit four big chances and seven shots on target.
South Africa despite dia 5% possession, get only one shot on target wey dem no fit create many chances to score.
Oswin Apollis na dia only player wey try two shots from outside di box; one of dem test di keeper but di oda one go wide.
Dia striker Evidence Makgopa struggle to get any chance to score - Khuliso Mudau also try im best from di wings to create somtin but e no happun.
For South Africa, dia defender Mbekezeli Mbokazi bin run di show wit at least three blocks and one goal-line clearance for di game.
Di 20-year-old Chicago Fire defender get all di headlines for im man-of-di-match performance.
But for Canada, dem go dey happy say finally dem take one of dia plenti chances for di game afta Jonathan David, Jonathan Promise and odas struggle to find di net.
Wit dis result, Canada go dey wait for di winner of di match between Morocco and Netherlands to sabi who dem go meet for di R16.
South Africa now become di first African kontri to comot di competition for di knockout stage.
Eight oda kontris for di continent go now try dia best to see if dem fit progress to di R16 stage.
'We go look back at our performance wit happiness' - South Africa coach Hugo Broos
South Africa coach Hugo Broos tok say im dey proud of di team wit wetin dem achieve to reach di R32 stage for di competition.
"Na tough game but we sabi bifor di match say tins go dey hard, sake of we don analyse di opponent well. We try to find solution to dia power and speed, but tins no work for us".
Hugo Broos add say "we gatz work on our power and speed for South Africa, sake of man-for-man, we no fit follow Canada for dis game".
Despite di defeat, di 74-year-old coach say "we get no complaints, we gatz look back for di tournament wit happiness sake of we don reach di second round".
"Nobodi give us dat chance bifor di competition. We don try well well for our first time for di World Cup in 26 years."
Di coach bin tok bifor di tournament say im go leave di job afta di World Cup, but im tok inside post-match interview say im go first tink about am.
"Right now, I no fit make any decision - sake of e go be emotional decision, so I gatz take time afta all dis, to decide my future."
'You guys na Canadian heroes' - Jesse Marsch tell im players
Canada coach Jesse Marsch bin dey cloud nine afta im team beat South Africa to reach di R16.
In fact, for di first half, Marsch bin vex say di referee no give dem penalty bifor halftime.
Im try to confront di referee for halftime but one of di Canadian players block am.
Afta di game, Jesse Marsch say "you guys na Canadian heroes. Canadian heroes for di future children for dis kontri wey dey play football".
"Football get ogbonge future sake of you guys, you gatz dey proud of who you be. You gatz dey proud of dis game."
Canada captain wey score di winning goal, Eustáquio say "we neva stop dey believe for dis game, I tink say we deserve dis goal".
Canada welcome dia star player Alphonso Davies for di first time for di World Cup for dia game wen im enta di game for di second half.
Di Bayern Munich star bin suffer plenti injuries last season wey im just return.
Im return go boost di Canadian team now as dem qualify for di R16.