US Supreme Court reject Donald Trump executive order on birthright citizenship

Published
Read am in 4 mins

US Supreme Court don reject Donald Trump attempt to deny automatic citizenship to children wey dem born for di kontri to undocumented migrants.

Justices vote 6-3 opinion in favour of birthright citizenship.

Chief Justice John Roberts explain say di decision firmly reject di executive order wey Trump issue on di first day of im second term to stop citizenship for babies wey dem born for US to parents wey no be citizen or green card holders.

For im ruling, e invoke di history of di 14th Amendment, wey dem pass afta US Civil War to clarify di matter of citizenship for freed American-born slaves.

"Citizenship, den and now, na di right to get rights - to freely participate in our political community. Di pipo wey frame di Fourteenth Amendment extend dat promise to 'every free-born pesin for dis land,'' Roberts write. "We dey keep dat promise today.'

Di lower court bin don block di president order to stop federal agencies from issuing citizenship to children wey dem born for US soil if none of di parents be US citizen or lawful permanent resident (green-card holders.)

Di judgement on Tuesday go be di last judgment on dis matta.

Di president and im legal team no really get support among policymakers and legal experts, even for di highest court for di land don reject di order.

Majority of di nine judges no wan reverse di 150-year-old court decision and reinterpret federal law and di US constitution inorder to give Trump win.

Dis setback go surely frustrate di president, e go make am find new ways to control how migrants wey no get papers fit enter America. If dem reach America, den dem no go fit question di citizenship of dia pikin.

US President Donald Trump neva tok anytin about di defeat for di court.

Trump for years don tok say ending birthright citizenship na part of im immigration plan since 2015. Back den, Trump wey still be candidate, don call to stop am, say na "di biggest magnet for illegal immigration."

Im sign executive order wey go stop birthright citizenship as soon as e come back to White House last year, and e no dey miss di topic during im speech, even ontop Truth Social.

Just few weeks ago, e don post say US "no fit live wit di shackles" of birthright citizenship.

"E no dey sustainable for economy, and no oda kontri dey do am," e tok.

For April, wen di court first seat, Trump post for social media say: "We be di only Country wey dey STUPID enough to allow 'Birthright' Citizenship!"

Di US na one of about 30 countries - mostly for Americas - wey dey grant automatic citizenship to anyone wey dem born within dia borders.

For oda kontris for Asia, Europe, and parts of Africa, dem dey follow jus sanguinis (blood principle) wey mean say pikin go inherit nationality from dia parents, no matta wia dem born dem.

How birthright citizenship start for US?

Di concept of birthright citizenship, wey dem dey call "jus soli", di matta dey base for English common law, and e dey generally apply to white men during early American history.

But e no become part of di Constitution until 1868, wen dem pass di 14th Amendment afta di US Civil War in order to settle di di matter about citizenship of freed, American-born slaves.

Previous Supreme Court cases, like Dred Scott v Sandford for 1857, bin tok say African Americans no fit be US citizens. Di 14th Amendment change dat.

For 1898, di US Supreme Court rule say birthright citizenship dey apply to di children of immigrants for di case of US v Wong Kim Ark.

Wong na 24-year-old pikin of legal Chinese immigrants wey dem born for US, but dem no gree make am enter back wen e return from China visit.

Wong argue say becos dem born am for US, im parents' immigration status no go change di matter for 14th Amendment.

Di court rule in Wong favour and outline some exceptions to birthright citizenship, such as for children of diplomats.