You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
South Africa, Ivory Coast and kontris wey don qualify for Round of 32 of 2026 World Cup
Di ongoing 2026 Fifa World Cup wey dey happun for di United States of America, Canada and Mexico don begin take shape.
Kontris don begin qualify for di knockout stage wey be di Round of 32.
Out of di 43 kontris wey come di tournament, only 32 go qualify for di first knock round.
Even though some teams don already qualify for di Round of 32 stage, oda kontris dey press calculator and also monitor oda groups to know dia fate.
Some kontris go wait untill di last group matches bifor e go sure for dem.
African kontris wey don qualify for di Round of 32
Some pipo no too give African kontris for di World Cup chance sake of how dem bin start di tournament.
But now some African kontris don qualify and odas wey get chance as best losers from dia groups fit still qualify.
Morocco - Di Atlas Lions qualify from Group C afta dem finish second wit seven points. Dem even dey on same points wit group leaders Brazil but na goals difference separate dem. Morocco win two of dia matches dem draw one.
Ivory Coast - Di Elephants get six points from Group E, dem win two matches kon lose only one. Dem get di same points wit group leaders Germany but na goals difference separate dem.
South Africa - Di Bafana Bafana finish second for Group A afta dem win one match and draw di oda one. Dem get a total of four points behind group winners Mexico.
Oda kontris wey don qualify for Round of 32
Group A: Mexico
Group B: Switzerland, Canada, Bosnia & Herzegovina
Group C: Brazil
Group D: USA, Australia
Group E: Germany, Ecuador
Group F: Netherlands, Japan, Sweden
Group I: France, Norway
Group J: Argentina
Group K: Colombia