Ivory Coast 0-1 Norway live updates of World Cup 2026 round of 32 match

Published
Read am in 5 mins

Second Half

49 Ivory Coast player pass ball wey corss Norway 18 yard box, corner for Ivory Coast, dem play am but Norway defence clear am.

48' Ivory Coast start dis second half wit beta ginger again as dem dey try create chances.

47' Freekick to Ivory Coast afta Norway foul Ivory Coast player.

46' Second half don start

First Half

Half Time

Ivory Coast 0-1 Norway

45+4 Referee don blow whistle for half time.

45+3 Ivory Coast dey play well for dis first half but dem neva see goal, Norway just see half chance and dem score.

45+1 YELLOW CARD! Antonio Nusa of Norway don collect Yellow card afta e foul Ivory Coast player. Antonio Nusa na im just score Norway goal.

45' Referee don add 4 minutes

44' Ivory Coast don get plenti corner kick chnaces but all dia attempt dem neva bring any goal.

42' Norway dey put pressure on Ivory Coast since dem score, Norway don miss three chances just now, one of dem na Sorloth wey pass ball to Haaland but Haaland no too balance as e head di ball to corner.

Ivory Coast 0-1 Norway

39' GOALLLLLLLLLLLLL for Norway! Antonio Nusa score for Norway as e fire di ball from outside di goal area straight inside di top right corner of di goal post afa Martin Odegaard pass ball give am.

38' Odegaard of Norway pass ball to Sorloth wey pass di ball to Odegaard but Ivoey Coast defence too storong dem black all di shots.

37' Sorloth of Norway pass di ball to Haaland wey head di ball towards goal but di header no get power as Ivory Coast goalkeeper catch di ball.

36' Ivory Coast dey lead di ball possession but di difference no too big for Norway.

34' Diomande of Ivory Coast play dia corner kick, dem use di ball dey dance around Norway defence untill e hgo out of play.

33' Norway don collect ball from Ivory Coast hand and dem dey play short-short passes for di midfield to dray Ivory Coast come outside.

32' Nicolas Pepe of Ivory Coast dey give teammates beta passes but dem neva still find di net till now.

30' Ivory Coast do beta counter attack as dem dey make attempt to score but e enta corner kick. Dem play am but e go corner kick again.

28' MISS! Beta chance for Ivory Coast, Nicolas Pepe get chnace to fire straight shot inside net but e pass am give im teammate wey play am go meet Norway defender wey clear di ball go corner kick.

27' Dem don return from water break and match don continue.

23' Corner kick for Norway dem play am but Ivory Coast defenders clear am comot but in di process Yao Diomande collide wit Norway player, referee blow freekick, but time don reach for water break.

21' Ivory Coast get chance to score but di player afta e delete di defenders wey dey im front, e put di ball for di side net.

20' Norway try enta Ivory Coast goal area but defnder clear am.

18' Ivory Cost dey worry Norway for di last two minutes for dia goal area, Ivory Cost hold di ball but Norway defender force di ball go out of play for danger zone.

15' Corner kick for Ivory Coast but Norway defence clear di ball.

13' Alexander Sorloth of Norway carry ball dey run go Ivory Coast area but Ivory Coast young defender tiff di ball from im leg , Sorloth fall for ground.

10'Ivory Coast no dey give Norway chance to play dia game as dem dey follow Norway players neck to neck.

9' Pepe of Ivory Coast play di corner kick wit beta cross but e no meet any of im teammates wey for fire am enta goal.

8' Ivory Coast get chance for Norway goal area but defender no let am pass, corner kick for Ivory Coast.

7' Norway fans full evriwai for di Dallas stadium dey ginger but Ivory Coast fans even though dem no plenti still dey show diasef.

5' Norway dey control di ball now as dem dey do short-short passes., dem dey try build up from back.

3' CHANCE for Norway, Erling Haaland head di ball for Ivory Coast goal aread but e land fpr defender body wey laster clear di ball to safety.

2' Ivory Cost start di match wit beta ginger as dem hold ball ball Norway don collect ball from dia leg.

1' Match don start

Starting Line up

Ivory Coast : Y. Fofana; Doue, Kossounou, Agbadou, Konan; Oluai, Sangare, Kessie, Y. Diomande; Pepe, Bonny.

Norway: Nyland; Pedersen, Ajer, Heggem, Wolfe; Odegaard, Berge, Berg, Sorloth, Haaland, Nusa.

Both Ivory Coast and Norway shine well for di group stage, but one of dis two teams go crash out of di World Cup few hours from now.

Na di first time Ivory Coast dey play for di World Cup knockout stage, and dem go begin dia title chase against strong Norway side, wey superstar striker Erling Haaland dey lead. Im don shine well for im first World Cup tournament.

Ivory Coast na one of di record nine African teams wey qualify for di round of 32, and wit talented young player Yan Diomande for dia squad, dem hope say Africa go continue di impressive run wey di continent dey get for di 2026 World Cup.

Afta three straight group-stage exits for di 2010, 2014 and 2018 World Cups, Ivory Coast don finally qualify for di knockout stage.