Key events wey don happun since kidnap of schoolchildren for Oyo and Borno states

Teachers carry placards to protest school pupils and teachers kidnap
Published
Read am in 6 mins

Di kidnap of plenty pupils and teachers from schools for Oriire Local Government Area of Oyo State south-west Nigeria and for three schools for Borno state north-east Nigeria on 15 May, don spark widespread outrage across di kontri.

Nigerian lawmakers dey among di latest to condemn di rate of kidnappings as dem renew calls for comprehensive reforms to di kontri security architecture.

For di Senate plenary on Tuesday, di lawmakers bin observe one-minute silence in honour of di two teachers and one pupil wey die in connection wit di attack.

Peaceful protests for di release of di abducted teachers and children also dey go on across di states of di federation, as dem don dey captivity for more dan two weeks.

These kidnapping incidents don bicom one of di most significant school abduction in recent years, since di Chibok and Dapchi cases, and e bring back painful memories to di minds of Nigerians.

Here na key key events wey don happun since di 15 May schools kidnap.

How e take happun

One man hold gun and cover im face

On Friday, 15 May, gunmen bin attack three schools for Oriire local govment area of Oyo state and kidnap at least 39 schoolchildren, wey include toddlers and seven teachers.

Local tori say di bandits kill one school teacher during di attack, and later also kpai anoda teacher inside di forest.

Di attack happun for Baptist Nursery and Primary School (Yawota), Community Grammar School (Esiele), and L.A. Primary School for Ahoro-Esinele, Oyo State.

Di govment blame di abductions on one faction of di Islamist militant group, Boko haram.

More dan 1000 kilometres away for Mussa town, Askira Uba local govment of north-eastern Borno state, parents still dey mourn di absence of dia children.

Di same day wey di Oyo kidnap happun, armed men also attack three schools for di community and kidnap at least 50 schoolchildren. Two students escape. About 48 of di children, some as young as two years old, still dey for captivity.

Di Borno and Oyo state schools kidnap incidents happun for di same day inside wetin security experts don describe as di worst attacks wey target schools for Nigeria.

Authorities don since close di schools down. Some of di affected students bin dey write dia certificate examinations, to fit qualify for university admission later dis year.

NUT direct nationwide protest

Teachers protest wit placards

On Tuesday, 2 June, thousands of teachers across Nigeria enta streets inside one coordinated nationwide protest, to demand di urgent rescue of dozens of schoolchildren wey still dey di captivity of kidnappers for Oyo and Borno states.

Di demonstrations wey di Nigeria Union of Teachers (NUT) organize bin start on Monday and e spread across several states wey include Akwa Ibom, Lagos, Borno, Rivers, Osun, Edo and di Federal Capital Territory. Teachers for Oyo and Ogun states bin don earlier demonstrate.

Di teachers union say di protests na show of solidarity wit colleagues and pupils wey gunmen gbab during coordinated attacks on schools for Oyo and Borno states - incidents wey don trigger fears about di safety of educational institutions for Nigeria.

For cities like Maiduguri, Uyo and Lagos, hundreds of teachers march through di streets, dem carry placards and chant solidarity songs, wey call for di immediate release of di kidnapped children plus dia teachers.

Many of dem also urge di federal and state authorities to intensify efforts to tackle di worsening insecurity wey dey affect schools and communities across di kontri.

Bifor di protest, di NUT bin ask all di public primary and secondary school teachers for Oyo State to withdraw dia services from schools beginning Monday, 1 June, until further notice.

Tinubu order deployment of forest guards, send delegation

President Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Presidency

Following di schools abduction mata, President Bola Tinubu bin approve di appointment of 1,000 forest guards plus di deployment of one special rescue team go Oyo state.

E also send on powerful delegation wey di Chief of Staff to di President Femi Gbajabiamila lead, alongside di National Security Adviser Nuhu Ribadu; di Inspector-General of Police Tunji Disu, di Minister of Defence, Christopher Musa plus di Special Adviser to di President on Media and Public Communications, Sunday Dare go Ogbomoso, to visit di places wia di kidnapping bin hapun, and to console di pipo wey dey affected.

Di govnor of Oyo State, Seyi Makinde, also join di presidential delegation "As part of immediate measures to strengthen security for di area, President Tinubu don approve di recruitment of 1,000 forest guards for Oyo State in collaboration wit di state govment."

Oga Tinubu bin also direct one specialised security unit wit advanced rescue capabilities to intensify efforts to secure di release of di abducted pupils and teachers.

Earlier, di Nigerian leader condemn di death of one of di teachers wey dem kidnap from one of di schools.

CAN declare three-day national mourning, call for state of emergency

Di Christian Association of Nigeria don declare three-day national mourning period wey go begin on 12 June 12 on top di worsening security situation for di kontri.

Di religious body also ask di govment to declare state of emergency on security across Nigeria sake of di kidnappings, terrorist attacks, and di destruction of communities.

In a communiqué wey dem issue at di end of di summit, church leaders express deep concern ova worsening insecurity, economic hardship, and declining public confidence for state institutions.

Dem say thousands of Nigerians dey displaced from dia ancestral communities, while many families continue to live in fear sake of persistent violence and criminality.

Di association condemn wetin dem describe as "barbaric acts of murder, beheading, torture, rape, abduction and forced displacement" and beg di Nigerian govment to take urgent, decisive and measurable action to restore public confidence and safeguard lives and property.

As part of dia resolutions, CAN declare Friday, 12 June 12, as di commencement of three days of national mourning, wey go continue until Sunday, 14 June.

Di association also say 14 June go be Black Sunday across churches for Nigeria in honour of victims of violence and in solidarity wit families wey di insecurity affect.

Senate, House of Reps chook mouth

Senate President Godwill Akpabio don ask di senate leader Opeyemi Bamidele to fix date wen dem go address di worsening security for Nigeria.

Dis dey come for di middle of growing concerns ova di mass kidnappings across parts of di kontri.

Di senate wey condemn di abduction of schoolchildren and teachers for Oyo State as plenary resume say di abduction na attack on di nation collective humanity.

"We resume our work under di mournful shadow of a tragedy wey don shake our nation. Di abduction of schoolchildren and teachers for Oyo State no be just attack on innocent citizens; na assault on our collective humanity," Akpabio tok.

E lament di kontri inability to fully guarantee di safety of children and educators, as e give assurance say dos wey dey captive go soon regain dia freedom through di efforts of security agencies and govment authorities.

Similarly, di House of Representatives don also urge di govment and security agencies to bring back di abducted school children and dia teachers alive.

Dem also call for di creation of state and local policing units.