OPay wey millions of Nigerians dey use dey shut down for Nigeria?

Fintech company OPay say no be true say dem wan close down and pack comot from Nigeria.
Chief Operating Officer (COO) of di company Dotun Daniel Adekunle tell tori pipo on Wednesday say di tori wey dey trend na fake news by haters.
Dis dey come after tori comot say di financial house dey shut down dia activities for Nigeria. Di rumor ask customers make dem withdraw dia money from di bank.
But OPay release online video on Tuesday, 1 September, to debunk di rumour. On Wednesday, 2 September, dem do press conference to clear di air about di matter.
Di Fintech wey say dem get almost fifty million customers invite tori pipo and social media influencers to help pass di message say dem no dey close down.
Oga Adekunle say Opay dey ok, say dem no dey go anywia.
"Dem say we dey shut down September 1, today na September 2, we still dey veri active and transactions still dey go on normal."
E say dem don engage di regulatory agency to look into di mata, say di regulatory agency don tok say di rumour wey dey circulate online na fake news.
"We dey here, we no dey run wit your money, we dey gidigba," na so e tok.
Oga Adekunle go ahead to clear di air say dia management neva take any decision to shut down.
E say "we go continue to protect our customers, dia money and notin go happun to dia money".
Dia lawyer Akinfolabi Rokosu say dem dey take legal action against pipo wey initiate di rumour, say any one wey dey responsible for di false information go face di law.
E say OPay don open 26 new offices across Nigeria dis year to prove say dem no dey go anywia.
"We still dey do millions of transactions. We get one million merchants and about 7000 staff."
OPay na one of few major fintech companies wey take ova di Nigeria financial sector wit easy banking systems and platforms for di last five years.
Plenty Nigerians join di platform and begin transact wit dem. In a few months millions of Nigeria don get account wit dem.
Dem dey unique sake of say if pesin use dia account to send money, di pesin fit confam di transaction in a mata of seconds.
Rumour of di shutdown begin hit di financial platform as di rumour begin trend, according to OPay COO.
Na im make dem take steps immediately to stop di rumours and di impact.
Disinformation and social media
Disinformation na one major wahala wey dey face not just Nigeria but di global community. Many organisations like BBC establish teams to fight disinformation.
Some pipo dey thrive by using online platforms to spread fake information, videos and pictures.
For recent months, May & Baker, MTN, Wema Bank and some oda corporate organisations don face similar situations wia fake rumours begin trend against dia platforms from social media posts wey pipo publish.
Since dem establish OPay for 2018, e don grow to be among di leading mobile money operators.
Di company don also expand beyond Nigeria into oda emerging markets across Africa and Asia, including Indonesia, Pakistan and Egypt.










