Wetin don change since Tinubu become president and wetin Nigerians dey tok

Wia dis foto come from, Ton Molina/Getty Images)
Nigeria President Bola Tinubu don spend three years ontop di seat of power and Nigerians don chook mouth into how di president don perform since e assume office.
President Tinubu become di fifth president of Nigeria since di kontri return to democracy for 1999 - afta e win di 2023 presidential election.
Dem swear am in for May 29 2023, to lead Nigeria, but questions remain if Tinubu don do well for office.
Many Nigerians dey complain of several tins, from insecurity to unemployment, fuel prices, exchange rates, hunger, amongst oda tins.
However, during di nationwide broadcast wey President Tinubu use mark di third anniversary since e bicom di president, e say im administration dey make progress for different areas.
But e add say im administration neva solve all di kontri problems finish.
President Tinubu say food prices remain low like e be bifor, and e also say Nigerian economy don become beta dan wetin e meet for office for 2023.
- Food prices
Issue of food no be play for Nigeria, becos pipo gatz chop and wetin prices tok for market go determine which kain food decision pipo go make.
We look wetin prices of food be for market bifor President Tinubu enta office for 2023, some of dis prices na wetin we get from di market, compared to wetin e be now for 2026.
Bifor, for 2023, one tuber of yam dey sell for as low as 800 naira, but by 2024, one tuber of yam dey sell for as high as 3,000 naira. Now for 2026, prices of yam no ready to come down as e dey climb go as high as 5,000 naira for one big tuber.
Garri wey be food for common man wey be around 500 naira for one paint dey currently sell for ova 2,000 naira, depending on some location.
One paint rubber of rice don currently dey sell for 7,000 - 8,000 naira for market.
Dis na part of wetin Oga Tinubu bin promise say e go address for 2023, but three years afta, e clear say some food items prices don increase.
- Security
During im 2023 inauguration speech, President Tinubu say security go be di top priority of im administration.
E say im administration go invest in di kontri security personnel, training and salaries.
Three years afta, Nigeria dey battle serious insecurity challenges from kidnapping of travellers to abduction of worshippers and students, and demand for ransom.
- Fuel subsidy
Fuel prices presently for Nigeria dey on di rise, as drivers dey buy as high as 1,350 naira per litre.
President Tinubu stand on di removal of fuel subsidy, wit claim say e dey favour di rich pass di poor.
"Subsidy no longer fit justify im ever-increasing costs in di wake of drying resources," Oga Tinubu tok for 29, May 2026.
But despite di removal of fuel subsidy, di burden of fuel prices dey ontop di buyers.
Even despite different promises, Nigeria neva get fully functional govment-owned refinery wey go dey refine fuel.
BBC News Pidgin ask some Nigerians wetin dem tink say don change since President Tinubu enta office.
Godspower Olorunsaanumi say a lot don change for di last three years wey Tinubu don dey power.
"Our economy don witness some shift for di past three years wen di current president enta. We dey head towards a good one, but pipo still dey feel am sake of inflation."
E add say Tinubu administration don embark on some infrastructures wit hundreds of roads wey dey go on for different places at di same time for Nigeria.
"For education, di incessant ASUU strike no dey again, we dey on di right direction."
However, e say di rate of terrorism for di kontri dey worry belle, but dey hope say tins go soon become beta.
David Toluwase say im im don see changes for area of di economy under Oga Tinubu.
"Economically, di kontri don witness strong reforms wey don cause improvement for di foreign market but e dey lead to high cost of living for di citizens."
Oga David say Tinubu reforms suppose make life beta for di citizens but correct welfare no dey in place bifor di reforms dey come.
E say, even though Nigeria don witness some infrastructural developments, security na still big issue wey dey rise.
For Oga David, as Nigerians dey fear for dia own safety, Tinubu gatz act fast on di mata.
For Olaleye Komolafe, e lament di poor standard of living of pipo wey di removal of fuel subsidy cause.
"Dat na di only tangible tin wey di masses dey directly benefit from di govment. Di removal stop di purchasing power of pipo, and tins neva be di same since dat time."
"Pipo now dey poorer dan e be bifor for 2023."
E also chook mouth for di mata of insecurity wey don lead to lost of lives under di current administration.
Nigerian analyst Ayobami Akinola say di major big concern to Nigerians under dis administration na di insecurity wey pipo dey battle.
E say insecurity dey add more problems to wetin Nigerians get for dia table already and Tinubu govment gatz face am
"Citizens no need war room details, dem need to see say di state dey work, say mechanisms dey, timelines dey, and consequences dey."
"Di problem no be primarily lack of brave men on uniform. Na di fact say Nigeria security architecture dey designed for different era and different set of priorities."
All dis views by Nigerians dey point to one clear fact say di Tinubu administration still get plenti tins to address - and as we head to di 2027 general elections, Nigerians need more dan reassurance but clear actions.










