Four pipo land for court afta dem stab baby 15 times till death

Wia dis foto come from, Taiyou Nomachi via Getty Images
- Author, Alex Moss
- Role, Yorkshire
- Author, Steve Jones
- Reporting from, at Sheffield Magistrates' Court
- Published
- Read am in 4 mins
Two men and two women wey dey face charges for court ontop say dem kpai one baby girl afta dem stab her plenti times for one house wey dey for Sheffield.
Dem find di newborn baby - wey court refer to as baby S - for one property for Holywell Heights, for di Wincobank area, on Sunday.
Di baby get 33 wounds from 15 separate stabbings.
One 20 years old man wey bin dey stay for Sheffield, show face for di Sheffield Magistrate Court wit 19 years old guy, 37 years old woman, and 38 years old man wey all of dem na from Holywell Heights.
Dem charge dem wit murder, causing or allowing di death of small pikin and dem bin dey try to block di course of justice.
Dem bin dey take steps to hide say dem no kpai di small pikin.
Anoda fifth pesin, wey be 15-year-old girl, wey dem no go fit call her name sake of legal reasons, also show face for di same court, she dey charged wit blocking di course of justice.
Court remand all five of dem wey be Slovakian nationals into custody, dem go appear for Sheffield Crown Court on Thursday.

For di hearing on Tuesday, dem tell court say dem find di baby deadibody on top of washing machine for di outhouse and dem bin wrap am inside towel inside one blue bag.
Prosecutor Luke Hopkinson say di defendants bin dey accused of blocking di course of justice by cleaning di scene.
Earlier, police say two women, wey dey 26 and 37 years old, wey dem bin arrest on suspicion of murder still dey on bail.
Detective Inspector Tom Woodward wey bin speak ahead of di court hearing say: "Dis na significant step for our investigation into di tragic circumstances wey result in di death of dis baby girl.
"I go like to tank our communities, wey I know say go don dey deeply impacted by dis traumatic incident, for supporting us as as we dey work through dis intricate investigation.
"We go ask di public to avoid speculating and posting information online about dis case while di legal process take im course.
"Protecting di integrity of di criminal justice process dey crucial to us to secure justice for dis little girl."
Police say officers go continue to dey in and around di Holywell Heights area to carry out inquiries.










