March and March protesters clash wit foreign nationals for South Africa, pipo injure

Man open mouth wey get blood

Wia dis foto come from, Rajesh JANTILAL / AFP via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Serious fight start between members of South Africa March and March movement and some foreign nationals for di kontri.

Di fight sup on Thursday 3 September, 2026, wen members of di March and March movement say dem go do clean up for some streets for Durban area.

March and March movement na di organisation wey dey lead di push for foreigners to comto for South Africa.

Dia push lead to di June 30 deadline wey make make kontris begin dey evacuate dia citizens comot from South Africa, and di group also lead big protest against wetin dem call 'illegal migration'.

Di group don again issue September 30 deadline for foreign nationals wey no get di right documents to comot for South Africa, and by dat time, dem wan enta streets protest again.

For di incident were happun on Thursday, di clash lead to serious fight wia pipo begin dey throw stones and some use sticks to hit each oda.

Some pipo begin dey run for safety as di fight dey get out of hand just bifor police come step in to control di situation.

Police confam say some foreigners throw stones and one land ontop a police officer head.

Di incident lead to di arrest of one foreign national alreadi, some pipo injure during di fight and police say dem don make some arrest.

Police say di violence bin begin from wia March and March members dey do clean up, and dem go mistakenly pick items wey belong to foreigners.

"On Thursday afternoon, 3 September 2026, approximately 100 marchers go on wetin dem call clean-up campaign wia dem allegedly picked up essential belongings from di foreign nationals, and physical confrontation begin."

Police say dem go process di case of di foreign nationals wey dem arrest sake of say e assualt a police officer during di fight.

Di police also mention say some of di foreigners bin dey camp outside Home Affairs office for Durban, wen di March and March protesters show up.

"Police in KwaZulu-Natal dey di process of registering case against a foreign national wey assault one police officer wit stone during confrontation between pipo wey dey march and foreign nationals wey dey camp outside di Home Affairs office for Che Guevara Road at Umbilo in Durban," di police say.

Di police dem get enof deployment on ground to control di situation.

"Police gatz use minimum crowd management force to manage di situation and we don restore calm."

More Investigations dey go on and police say anyone wey dem find say e dey behind di violence go face di law.

'Ten of our members injure' - March and March leader tok

Na officer of di South African Police Service try stop di figh afta some members of March and March movement sustain injury wen dem clash wit foreign nationals for Durban.

Di protest na for di port city of Durban wey don dey for di centre of action against irregular migration.

Di leader of di March and March Movement, Jacinta Ngobese-Zuma tok shortly afta di fight sup say dem dey clean di area bifor some migrants launch attacks on dem.

"We get information for di pipo of di community, so we come clean di community. We inform di police about di clean-up."

"Na so we see say some guys begin dey attack on our members wit stick, na so di whole tin begin turn into violence."

According to her, she say na ten of her members don injure for di fight and dem go lodge formal complaint to di police.

"Ten of our members dey injured, and some chop teargas. Di police say we no suppose come clean di road becos plenti foreigners dey for hia."

Jacinta accuse di police say dem no protect di March and March members, but rather ask dem make dem comot for di area.

Meanwhile, some trending videos show as South African citizens dey face di foreigners while some dey run for safety.

Nigeria and Ghana dey among kontris wey don evacuate dia citizens comot from South Africa sake of di attacks while oda kontris don also withdraw dia citizens.

However, South Africa govment don also promise say dem go punish pipo wey dey illegally attack foreigners.

Cyril Ramaphosa say dem don begin process to prosecute offenders and evrione wey dey violate di law.