Nigerian fashion designer welcome arrival of baby girl wit Instagram page for di pikin

Published
Read am in 4 mins

One of Nigerian top Fashion designer, Veekee James Atere don announce di birth of her daughter wit her husband, Femi Atere afta two years of marriange.

Di fashionista wey dey well know for her bridal and red carpet designs bin make di announcement for her Instagram wey she follow open one for di pikin.

For di announcement she reveal say di name of di pikin na Eliana Adeife Atere wey dem born on 2 May 2026.

She explain di name choice say, na "EL (God) and ANA (He has answered), signifying 'My God has answered'."

She bin announce di pregnancy for February dis year wia she bin reveal say dem bin dey try get di belle for one year.

Den dem come announce say dem go Dubai go do gender reveal and na for dia dem fin out day di pikin na girl.

Meanwhile many pipo don start ot dey congratulate di couple for di comment section of di video.

Actor, Stan Nze and actrees Shaffy Bello share dia own congatulations.

As long time friend and content creator, Tomike Adeoye also chook mouth for inside di comment section but also make her own post wia she refere to WEliana say, "Wen you dey old, I go tell you di tori of how your mama dey design di dress wey break di internet for hospital bed. A queen and more. You get di best mama and papa wey any girl fit wish for".

Dis dey come as for Saturday, actress, Osas Ighodaro bin debut di design wey VeeKee James bin make for her for red carpet wey di design bin dey made of iron sponges.

Who be VeeKee James?

Veekee James na fashion designer wey dey know for her structured bespoke outfits wey she dey make for both bridals and red carpets.

She bin grow up for Ajegunle, one of di slum areas for Lagos South west Nigeria.

She bin go school wia she bin reason say she go gradute to turn to career woman but no be di way di tori waka for her.

Veekee James tell BBC Pidgin say she decide to focus on wetin she say na her 'Obioma' work, wey don bring her fame for di fashion industry.

"Di way I take start fashion, me I no even know say I go be fashion designer"

She explain how she take start di fashion from her mama parlour becos her mama na tailor.

She don make clothes for stars likee actress Sharon Ooja wedding dress, content creator Priscillia Ojo wedding dress as well as red carpet looks for di likes of Osas Ighodaro, Toke Makinwa among odas.

Veekee also share her experience as she take drop out of school and pursue her hustle.

"I no go tok say na di best tin for everibodi to do but for me na di best decision wey I don make for my life.

Even though she bin tok for dat interview say men dey find her kain success to dey intimidating, for February 2024, she marry her husband Femi Atere.

Na she her self design all her wedding looks for di different ceremonies.

Since dem marry, Veekee James don add more festhers for di cap of di work wey she dey do. She don start to dey do work as content creator and even don turn gospel artiste and podcaster wir ger podcast wey she call "Bible Stories wit Veekee James".