South Africa security ministers meet ova anti-immigration protests as Ghana prepare to evacuate ova 800 citizens ova xenophobia

security ministers in south africa are in an emergency meeting

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, Ghana Foreign minister meet wit citizens wey dey prepare for evacuation to Ghana ova xenophobia attacks
Published
Read am in 5 mins

Di South Africa govment don confam say dia security ministers dey meet to discuss di rising anti-immigration protests across di kontri wey begin for early April.

Vigilantes and anti-immigration protesters dey ask foreigners to leave di kontri as dem dey accuse dem of taking dia jobs and committing crime.

Di foreigners, wey largely be African nationals, don deny dis allegations wey dem tok say dem just dey di kontri dey do dia business, wey some bin dey dia for asylum.

But di March and March movement especially bin dey involved for all di protests wey dem dey insist say foreigners gatz comot di kontri.

In fact, for some communities and provinces, local authorities don pursue foreigners wey dem seize di keys to dia shops.

Di mayor of Estcourt for example bin give foreigners for dia neighbourhood 30 June deadline to pack dia tins and comot di area.

African kontris like Nigeria, Angola, Ghana, Ethiopia and odas don condemn di attacks on foreigners wey dem ask South African authorities to call dia pipo to order.

Di international community also bin chook mouth for di development for di kontri - di United Nations (UN) and di African Union (AU) all condemn di xenophobic sentiments.

Di AU dey expected to discuss di issue of xenophobia for dia midyear coordination meeting for Egypt wey go happun for June.

the evacuees are entitled to some allowances upon return to Ghana

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, Some Ghanaians carry dia tins go di High Commission wey dem dey undergo screening ahead of di Wednesday evacuation

Emergency security meeting dey underway

Di South Africa govment say di Justice, Crime Prevention and Security (JCPS) ministers bin dey one emergency meeting "to discuss di rising protests on immigration and illegal foreigners for di kontri".

"Di meeting dey happun for di Union buildings for Tshwane wey get all di security cluster Ministers and senior officials in charge for national security for di kontri," di govment tok.

Di statement from di JCPS cluster tok say "di meeting of di ministers go finalize di framework on di national action plan to combat racism, racial discrimination, xenophobia and oda forms of intolerance."

Di ministers go later meet political parties, various groups and associations wey dey involved for mass protests and marches against illegal foreign nationals across di kontri.

South Africa govment say dis meetings go now "establish di rules of engagement for protests but di meeting go also discuss govment programmes and plans to deal wit di serious illegal immigration wahala.

MArch and marcj movement say they would keep protesting until end of year

Wia dis foto come from, SOUTH AFRICA PRESIDENCY

Wetin we call dis foto, South Africa president Cyril Ramaphosa say di konri gatz deal wit illegal immigration and oda tins wey dey affect di kontri

Ghana dey screen ova 800 citizens for evacuation on Wednesday

Ghana High Commission officials don confam say dem dey screen hundreds of citizens ahead of evacuation on Wednesday.

"Ova 800 pipo don register now, we dey screen dem and process dem for di evacuation. Di first batch of 300 go dey ready to enta di flight to Ghana," di High Commissioner Benjamin Quashie tok.

Im add say "at least 25 Ghanaians don confam say dem suffer physical attacks from South Africans for various communities. Dis be unacceptable wey we no want make oda nationals decide to carry out reprisal attacks against South Africans."

Di Ghanaian authorities say dem go ensure di safety of all di citizens.

Di govment apart from say dem go evacuate di citizens free of charge, say dem go give all di pipo wey go return wetin dem call welcome moni and transportation to dia various locations.

Dem also go give dem somtin dem call re-integration allowance and psychological support bifor dem go add dia names for one job platform.

International bodies have condemned the attacks and called on authorities to address the matter

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, Some Ghanaians say dem dey live in fear as dem dey under constant attack and harassment from South Africans

Protests dey expected to continue for Durban, Johannesburg and oda places for di kontri.

Even as South African authorities dey try to fix di wahala, di citizens dey insist say foreigners gatz leave.

Dem say make di foreigners go fix dia own kontris, make South Africans fit enjoy life for dia own kontri.

Security analysts fear say tins fit get worse if dem no find quick solution to dis tension.

Dem say e get di potential to also scata di diplomatic and bilateral relations between South Africa and oda African kontris.