Why Speaker of Senegal parliament Malick Ndiaye resign afta President Faye sack Prime Minister Sonko

Malick Ndiaye, Speaker of Senegal National Assembly

Wia dis foto come from, Turkish Grand National Assembly/ Handout/Anadolu via Getty Images

Published
Read am in 3 mins

Di political wahala for wey dey go on for Senegal currently don increase as di Speaker of di kontri National Assembly, Malick Ndiaye, resign late on Sunday.

Dis dey come just two days afta President Bassirou Diomaye Faye comot Prime Minister Ousmane Sonko, im former paddy wey im and am don dey quarrel for long.

Speaker Ndiaye, for im resignation letter tok say di decision na "personal choice" and na for "di greater interest of di Nation".

Ndiaye and Sonko na strong allies and analysts say im resignation dey strongly related to di sacking of di former Prime Minister.

Dis move by Ndiaye, according to sabi pipo, don clear di way for Sonko to contest for di position of di Speaker of di parliament and e dey expected to win am easily.

Di Pastef party wey Sonko be di leader dey control di parliament by 130 seats out of 165.

Sonko na di major opposition leader under di administration of former President Macky Sall, and e for win di presidential election if no be say dem ban am from contesting sake of say court bin find am guilty of defamation.

Both Faye and Sonko bin dey for prison ahead of di 2024 election, and na just 10 days to di election date wey dem come out.

Na within dat 10 days Faye take part for im campaign wit di slogan: "Diomaye moy Sonko, Sonko moy Diomaye" (Diomaye na Sonko, and Sonko na Diomaye), and e go on to win wit 54 percent of di vote.

Wetin go hapun now?

Pastef party get di ogbonge majority for di Senegalese National Assembly and Sonko na di undisputed leader of di party.

In April dis year, di lawmakers pass law wey change di electoral code to tok say pipo wey get convictions for minor offences fit still dey eligible to run for di office of di president, and sabi pipo say na bicos of Sonko dem pass dis law so dat e go fit contest for di 2029 presidential election.

According to official document wey di national assembly publish on Sunday, di lawmakers go hold a session on Tuesday to reinstate Sonko as member of parliament and vote for new speaker, wich Sonko dey expected to win.

If Sonko return to di parliament and contest for di post of di Speaker and win, analysts say e fit mean more wahala for President Faye who still gatz nominate new Prime Minister, and di parliament gatz approve di nominee within three months.