You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin to do for flood situation as at least 12 pipo die, odas dey missing for Ghana floods
Rain wey last from Sunday to Monday for many parts of Ghana kpai at least 12 pipo.
Many odas dey missing afta flood waters sweep across di kontri.
Wit di Ghana Meteo prediction of more rains for July, tins dey scare residents for many parts of di kontri.
For di recent rain, thousands of pipo lose dia properties, di floods carry cars, room fittings, furniture and oda equipment.
Some warehouses also dey affected wey dem lose all dema products.
For many hours, pipo dey trapped for dia homes in wetin be one of di worst flood situations for di kontri.
Di Interior Ministry issue stay-home order on Monday as di rains continue throughout di day.
"Di public dey advised to remain wia dem dey until di conditions improve; pipo wey dey house gatz stay dia, dose wey dey work gatz stay dia and odas gatz move to safe locations," di ministry tok.
Dem also advise pipo to reduce movement during di rain.
For viral videos ontop social media, flood wash away di livelihoods and properties of pipo, wey storm drains overflow wey flood pipo dia houses, streets, churches, schools and oda places.
Flood waters cova cemeteries, bus terminals and oda places.
One rubber factory and market for Odawna around di Kwame Nkrumah circle bin catch fire wey e burn di whole day sake of floods prevent fire-fighters from reaching di scene of di fire.
For at least two locations, buildings bin collapse wey injure pipo.
Di Ghana Police Service, Military, Fire Service, National Disaster Management Organisation (Nadmo) and oda agencies work overtime late into di night to rescue trapped victims.
Tok-tok pesin for di Ghana National Fire Service, ADO1 Alex King Nartey confam say dem recova at least 12 bodis so far.
"We retrieve about 12 bodis since Monday but di number fit rise sake of many oda pipo still dey missing. Two pipo die for Alogboshie, one pesin die for Abofu wey anoda four pipo die for Odawna. We also find two bodis for Alajo - one pesin die from electrocution," ADO1 Alex Nartey tok.
Im add say "anoda pesin for im 60s also die for Alajo bifor we also find anoda two pipo – one woman and one man for Tema New Town, we still dey try to search and rescue odas".
In all, di security services and oda pipo rescue more dan 470 pipo wey dey trapped for many places for di kontri during di rain.
Wetin President Mahama tok afta im do aerial inspection of affected places
President Mahama togeda wit di minister for Works and Housing, di Nadmo Director-General and oda security chiefs use helicopter to inspect di affected places for air.
Di aerial inspection give di president first-hand view of di way di floods destroy tins for Accra.
Di president sympathise wit pipo wey lose all dia properties.
"I wish to express my deepest sympathy to all di pipo wey lose dia property to di flood; di damage dey extensive wey many families dey affected."
President Mahama add say "at di same time I ask Ghanaians to change dia attitude to sanitation and waste disposal and building for waterways. We gatz find solution to dis mata".
"I already direct Nadmo to identify affected victims and provide immediate support for di coming days. I also order di finance minister to release some money for post-disaster relief support to dis affected pipo," Mahama tok.
Di president also order say make di various assemblies identify and demolish all structures wey dey for waterways and comot all illegal dumpsites for di city.
For Monday evening, some churches, schools and oda businesses open dia premises for victims of di flood to stay for di meantime, as rescue efforts dey continue for di places wey still dey flooded.
Alerts and flood safety tips
Security agencies dey available to help pipo during di rain and floods.
Di National Disaster Management Organisation (Nadmo), di fire service and odas agencies dey offer some tips for flood situation.
- Pipo wey need assistance gatz contact toll free number 112; to connect wit officers of di police, fire, ambulance, disaster management and military
- Unplug electrical appliances if water enta your house
- No try to chase properties wey floods dey carry go
- Stay indoors if possible
- Move to higher grounds if di water level dey rise
- Neva waka, swim or drive through floodwaters
- Neva stay inside your car during floods
- Take note of weather warnings and prepare
- Avoid dumping refuse inside drains during rain