'God no be man' - Nigeria former minister of petroleum Alison-Madueke react to UK court ruling wey clear am of all charges

Published
Read am in 3 mins

Nigeria former Minister of Petroleum Resources Allison-Madueke don tank God and pipo wey stand by am during her trial for di United Kingdom.

Court for UK on Wednesday, 17 June bin clear Alison-Madueke of six bribery charges.

Di court for London say she no dey guilty of di six bribery charges wey dem bin sama her.

Dem bin charge her wit five counts of accepting bribes and anoda charge of conspiracy to commit bribery, wey she deny.

Prosecutors ⁠allege say Alison-Madueke, wey be 65 years bin get "a life of luxury" for London ​from di oil and gas industry figures wey bin dey try to get big contracts for Nigeria, ​wey also get hand for mismanagement and corruption.

But di former minister say she no collect bribes and she bin no get any real ​influence ova who govment dey give big contracts to.

Alison-Madueke bin face trial wit oil industry executive Olatimbo Ayinde wey be 54 years.

For her reaction on Wednesday, Alison-Madueke say di trial dey traumatic for her, her family and friends wey bin support her.

"But I tell you dis, God go always do as God go do, and God go be God. God no be man wey e go lie. So wen e promise you somtin, e go do am.

"E don almost be 11 years wey I don dey here. I bin do my job to di best of my ability, but like I tok, God no be man wey e go lie. God na God, and we tank am."

Dem sama am wit one count charge of bribery wey relate to ​Alison-Madueke ⁠and anoda separate count of bribery of one foreign public official.

Alison-Madueke, wey be former minister for petroleum resources between 2010 and 2015 under former president Goodluck Jonathan, bin stand trial for London.

Alison-Madueke broda Doye Agama wey dey 69 also dey charged with conspiracy to commit bribery ⁠wit im sister wey relate to payments wey im bin make to ​Agama church.

Both Ayinde and Agama deny di charges against dem and court also ​acquit dem.

Afta di trial wey happun for di Southwark ‌Crown ⁠Court, London, di court acquit Alison-Madueke of all di six charges she bin face afta more dan 46 hours of wey dem spend to decide on di mata.

Tori be say di verdict from di jury wey say she no dey guilty na serious blow to British authorities, wey bin start dia ​investigation into corruption ​allegations against Alison-Madueke ⁠more dan 10 years ago.

Who be Diezani Alison-Madueke?

Diezani Alison-Madueke wey dem born on 6 December 1960 for Port Harcourt, Rivers State.

Na Nigerian politician and she be di first woman wey ever bicom president of di Organization of the Petroleum Exporting Countries (Opec)

She bicom Nigeria Minister of Transportation on 26 July 2007.

For 2008, dem move am go Ministry of Mines and Steel Development, and for April 2010, dem appoint am as di first female Minister of Petroleum Resources for Nigeria.

She later bicom di first female president of Opec for di 166th Opec Ordinary Meeting wey happun for Vienna on 27 November 2014.