Wetin dey inside US and Iran deal to end war?

Published
Read am in 3 mins

United States and Iran don marshal out framework deal wey go help end di war wey dey go on between dem.

Dia mediator wey be Pakistan say dem go sign di deal on Friday for Switzerland.

Iran and US don dey fight war since February 2026 wen US and Israel strike Iran. Iran respond by striking Israel and US ally states for di gulf region. Di war don consume plenti casualties.

Sake of di war, Iran close di Straight of Hormuz wey lead to rise in oil prices all ova di world. Di area na one of di busiest shipping channels for di whole world.

Wetin dey inside di deal

US President Donald Trump confam say "di deal wit di Islamic Republic of Iran don dey complete", say part of di agreement be say dem go open di Strait of Hormuz "make di oil flow" na wetin e post for social media.

Trump say e don order immediate removal of one US naval blockade for Iran port.

Iran Deputy Foreign Minister confam for live TV say true true dem don agree deal to end di war.

Some top military commanders dey hail di deal, say na victory for Tehran.

Pakistan Prime Minister Shebbaz Sharif say di two warring kontris don agree to do immediate termination of military operations on all fronts.

Tori be say di target na to extend di ceasefire wey dem agree for April make e reach more 60 days.

Anoda tori be say di deal get 14 points memorandum of understanding between di two kontris.

As at di time of publishing dis piece, di two kontris neva announce di specific points wey dey inside di deal.

For congratulatory joint statement, leaders of UK, France, Germany and Italy say Iran "must not acquire nuclear weapon", say dem dey ready to lift sanctions in response if Iran show clear and verified steps about dia nuclear programme.