'We dey in pain and e dey unbearable' - Retired Major General Rabe Abubakar family beg govment to rescue im wife

Published
Read am in 4 mins

Di family of retired Major General Rabe Abubakar don call on di govment to intensify efforts for di rescue of im wife wey still dey for kidnappers den.

Abubakar daughter wey follow BBC tok say di death of di retired military officer don put di family for unbearable pain.

She say make govment make effort for di quick release of dia mama wey di suspected terrorists gbab alongside wit dia father, wey still dey for captivity.

Ova di weekend, di Nigerian military confam di death of Abubakar wey die for di hands of terrorists' wey abduct am.

"Di Defence Headquarters regret to announce di passing of Major General Rabe Abubakar (Retired), wey tragically lost im life in captivity following im abduction,' di statement tok.

Dem lay di late senior military officer to rest on Sunday around 6:00pm for Katsina GRA mosque, im family and plenty mourners attend di funeral prayers.

Suspected terrorists kidnap Abubakar wey bin get high-profile job as military tok-tok pesin between 2015 and 2017, as e dey travel wit im wife for Katsina state last month.

Di daughter say di kidnappers no call di family for ransom, but dem follow di govment tok.

On how dem dey feel and how save dem be afta di death of dia father, di late major general daughter say "Di pain dey unbearable. Na only God go deliver us. We dey pray. Allah na only our safety. By God grace we go dey saved."

Meanwhile, Katsina state govment authorities wey also confam di death of di Maj Gen Rabe Abubakar say e die from complications wey relate to diabetes and hypertension.

For statement, Katsina state govment tok say im death na "dark moment", and say e show say make dem quick step up effort to fight di criminal groups wey dey disturb peace for communities across di region.

Plenty Nigerians don condemn di death of di late senior military officer for di hands of kidnappers.

Nigeria President Bola Tinubu wey 'express shock' ova di death say na warning to kidnappers to begin dey surrender now.

E say im govment no go surrender to bandits as e go kontinue dey treat dem as enemies of di kontri.

President Tinubu say di terrorists don do dia worst, but "govment will no go bow to dia demand to release dia members wey dey hand of our security agencies."

"As I say for June 12: Bandits, kidnappers, and sponsors of terror gatz surrender now or face di full force of di Nigerian State."

Local media report say Maj Gen Abubakar na 61 years old. Dem born am on 7 April 1965. E come from Batsari Local Government Area in north-western Katsina State.

Di state government add say despite all dia efforts to secure im release, di situation end "for dis tragedy", e describe im death as big loss to both Katsina State and Nigeria.

Dem commission Maj Gen Abubakar into di Nigerian Army as second lieutenant for 1989 and e go on to serve as di military tok-tok pesin from August 2015.

Local media bin report say di retired officer bin dey go one wedding on 30 May wen armed men attack im vehicle, seize am, im wife plus dia driver.

Days bifor tori of im death come out, one video bin go viral on social media wey show Abubakar for captivity. E get injury for im left leg, e dey wit im wife plus oda hostages for di video.

Di abduction and death of Abubakar show di security challenges wey continue to due face parts of north-west Nigeria, wia criminal gangs locally known as "bandits" dey frequently carry out kidnappings for ransom, dey tiff cattle and attack rural communities.

Katsina na one of di states most affected by di violence.

Who be major general Rabe Abubakar

Maj Gen Rabe Abubakar na retired senior Nigerian military officer wey serve for di army and hold big positions.

Oga Rabe na former military tok tok pesin between 2015 and 2017.

Nigeria Army say retired major general Rabe serve di nation wit distinction and hold many appointments including tok tok pesin of various military formations.

E also serve as well as tok tok for di Armed Forces of Nigeria wia e hold di post of Director Defence Information.

Dem say e make good contributions to counter-insurgency operations, professional development of di military amongst oda impacts.

Oga Abubakar na from Batsari Local Govment Area of Katsina State, north-west, Nigeria.

Dem commission am into di Nigeria army as second lieutenant for 1989.

E become defense tok tok pesin for August, 2015 afta e take ova from Major General Chris Olukolade.