'We go continue to protest until dem meet our demands' - Protesters tok ahead of June 30 deadline for migrants to comot for South Africa

Published
Read am in 4 mins

Di leaders of many civic groups, including di March and March movement wey dey organise series of demonstrations don tok say dem go continue to protest until dia demands dey met.

Dem yarn dis one for press conference wey still dey go on ahead of di 30 June deadline dem give illegal migrants to comot for South Africa.

Di acting police chief and oda security officials go also do press conference on di same day to explain security measures wey dem dey put in place.

Dis na sake of say pipo dey fear di say di deadline fit cause kasala and katakata evriwia next week.

Tori be say protests against illegal migration go dey happun evri day untill di month of June end.

Di South Africa minister of police bin meet wit oda national commissioner as part of dia preparation for di protests on Monday.

According to local media DailyMaverick, dem bin quote wia di police minister say South Africans get di constitutional rights to protest, but no go allow any act of lawlessness or violence.

"Di aim of di operations na to make sure say all foreign nationals wey dey stay for South Africa fit stay for di kontri legally and get valid documentation."

South Africa Minister of Justice Mmamoloko Nkhensani Kubayi dey monitor di evacuation of some foreign nationals.

Di Justice minister dey part of di Inter-Ministerial Committee (IMC) on Migration, and dem dey monitor how some migrants comot for South Africa by buses.

Dem also visit di king of KwaZulu, King Misuzulu kaZwelithini, for di Royal House wia dem go tok how govment dey make efforts to manage migration for di kontri.

Di acting Minister of Police, Cachalia bin dey do meeting wit Defence Minister, Motshekga ontop dis June 30 demonstrations, but di outcome of di meeting neva dey public.

Meanwhile, dem say na closed door meeting and media no go fit capture wetin dey happun inside, but na until afta di meeting di minister go tok.

Meanwhile dem don mark some provinces wey di protests don already affect and na di Gauteng, KwaZulu-Natal, Western Cape, and Eastern Cape provinces.

As di days dey go by oda Africans especially Nigerians dey fear for dia lives as dem no know wetin go happun to dem wen di protests really start.

Tori of how African kontris dey remove dia citizens from South Africa full evriwia.

Sake of di different protests wey don hpappun for South Africa wey don lead to harassment of foreign nationals kontris like Ghana, Nigeria and Malawi begin remove dia citizens since di threats bin start.

Accounts of immigrants wey don lose evritin, na real life tori for South Africa.

Di account of di Nigerian trader and businessman Wilson Oghodero show say Nigerian citizens wey dey live for South Africa dey under pressure.

Wilson tell BBC say di groups don warn say dem go carry out house to house search for documentation afta di deadline.

Dis don make tension dey rise among Nigerians wey still dey South Africa wey don register to leave di kontri.

Afta di first batch of Nigerians wey return to di kontri, anoda set neva come and e no dey clear why dem neva come.

We dey update dis tori as di press conference dey continue