'We no go accept dis' - Nigeria cut warning give South Africa afta dem confam killing of two Nigerians

Two presidents by di side, wit man wey dey hold stick

Wia dis foto come from, Getty Images

Published
Read am in 5 mins

Nigeria govment say dem no happy at all wit di recent killing of Nigerians wey dey stay for South Africa.

According to di Ministry of Foreign Affairs, dem tok say na wit shock wey dem receive di news of two Nigerians wey be Bishop Taiwo Michael Fakunle and Mr James Uchechukwu.

For statement wey di tok-tok pesin of di ministry Oluwafemi Adeniyi sign on 11 September, 2026 Nigeria govment condemn di killings especially as e dey happun wen foreigners, especially Africans, still dey struggle wit di devastating impacts of Xenophobic and Aphrophobic attacks for South Africa.

"Dem murder Bishop Taiwo Michael Fakunle, for im house for Kensington, Johannesburg, on Friday, 04 September 2026; and dem kill Mr. James Uchechukwu Nwankwo, from gruesome interrogation techniques by di Officers of di South African Police Service (SAPS) for Sommerset, Cape Town, on 05 September, 2026."

Nigeria govment say dem receive dis incidents wit grave concern and dem condemn di killings of Bishop Fakunle and Mr Nwankwo for di strongest terms possible.

Dis dey come as Nigerians and oda African nationals dey face deportation threats for South Africa.

"E dey extremely worrisome say law enforcement agents, wey get di responsibility of securing lives and property, dey make situation wey already no good , worse and e na unacceptable interrogation techniques wey dey always lead to di deaths of foreigners," Nigeri Foreign ministry tok.

Nigeria govment dey call on di relevant South African authorities to immediately start to chook eye and begin transparent investigations into di circumstances wey dey surrounding dis two killings.

"Nigeria dey expect say dem go give dis mata di attention and urgency wey e need."

Nigeria for di statement add say "constructive dialogue na means of resolving differences and we don consistently adopt di approach for our engagement wit South Africa in an effort to address di irritants of Xenophobia and Afrophobia."

'E dey unfortunate' - South Africa react to legislative ban from Nigeria Senate

Nigeria say dem bin don raise concerns about xenophobic attacks for both Ecowas and di African Union.

On Friday, Nigeria parliament bin suspend all official visits to South Africa and say dem go boycott parliamentary activities wey South Africa dey host until further notice.

Nigeria govment say di killings, attacks, intimidation and damage to property involving Nigerians and oda African nationals in South Africa too much.

South Africa International Relations Minister Ronald Lamola bin tell national broadcaster SABC say di decision by Nigeria National Assembly dey "unfortunate".

Im add say South Africa dey open to dialogue, and add say Nigeria bin provide list of about 100 Nigerians wey allegedly kpai for previous incidents, wey South Africa bin also confam.

Mr Lamola say make dem no undermine di bilateral relations as dem dey acknowledge di challenges wey dey involve Nigerian communities for parts of South Africa, including Johannesburg.

Nigeria Senate President Godswill Akpabio and House Speaker Abbas Tajudeen describe di suspension as "firm, measured response" to threats against Nigerians abroad.

'Killers go im house and shot am dead' - Femi Fani-Kayode comment on Bishop Fakunle killing

Nigeria ambassador to South Africa, Femi Fani - Kayode don also chook mouth ontop di Nigerians wey South Africans kpai mata.

For post wey im make for im verified social media handle, im tok say im dey shocked to hear about di murder of Bishop Michael Taiwo Fakunle by unknown pipo for Johannesburg on September 4th.

"Afta dem issue series of threats im killers go im house and shot am dead."

According to di former Nigerian Minister, dis deaths increase di number of Nigeria nationals wey don kpai for South Africa to eight dis year.

"Bishop Fakunle and Mr. Nwankwo na di 7th and 8th Nigerians wey dem don murder for South Africa dis year alone.

"No less dan 4 amongst di 8 bin dey murdered by South African police officers.

E add say outside dis death, "ova100 Nigerian nationals don dey murdered for South Africa between 2022 and today and ova 30 of dem dey killed by officers of di South African Police Service and South African Defence Force."

Diplomatic tensions between di two largest economies for Africa dey continue to get K-leg for recent months.

'We no go accept dis. We call on di South African Govment to do far more to protect our nationals and to bring to justice dose wey don kill or dey plan to kill dem," Fani-Kayode tok.

Di ambassador say no pesin suppose dey targetted and murder just becos say dem be Nigerian.

E say di Nigerian community for South Africa dey disturbed by dis killings and dey fear wetin fit happun next.

"We call on di South African Govment to protect our pipo from di excesses of dis racist organisations and dia members and to apply di full weight of di law against dem for dia lawless behaviour," di ambassador tok.

Nigeria, wit kontris like Ghana, Malawi, Kenya and Zimbabwe don remove some of dia citizens from South Africa sake of safety concerns.