US launch new strikes on Iran, wey target missile sites and boats

    • Author, Toby Mann
  • Published
  • Read am in 5 mins

US don launch new strikes on southern Iran, wey dey target Iranian missile sites and boats wey dey attempt to place mines.

Di US Central Command for statement tok say dem carry out di strikes in "self-defense" and e dey designed "to protect our troops from threats wey di Iranian forces pose".

Tok-tok pesin for di Central Command Capt Tim Hawkins tok say di US military "go continue to defend our forces while using restraint during di ongoing ceasefire" between di two countries.

Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) on Tuesday tok say dem crash one US drone and fire one fighter jet and anoda drone wey enta Iranian airspace, Iran Isna news agency report.

Di IRGC also say Iran get di "legitimate and definite" right to retaliate against any ceasefire violations by di US, according to Isna.

E neva dey clear di impact di strikes go get on any potential peace agreement between US and Iran.

Iran supreme leader, Mojtaba Khamenei, tok say "di nations and lands of di region no go serve as shields for US bases any longer," for inside one message to dos on di 2026 Hajj pilgrimage.

Following di US strikes, US Secretary of State Marco Rubio say deal still dey possible and e point to di tok-tok on Tuesday between Iran top negotiator and foreign minister and Qatar prime minister.

E say President Donald Trump don "express im desire to make di deal".

"E go either make a good deal or no deal," Rubio tok.

Wen tori pipo ask Rubio about Monday strikes, e say: "Dem gatz open di straits. Dem go open am one way or di oda. Wetin dey happun there dey unlawful, e dey illegal, e dey unsustainable for di world, e dey unacceptable."

Capt Hawkins say dem target di US strikes for one area near Bandar Abbas, one southern port city and home of one Iranian naval base wey sit on di Strait of Hormuz, according to di New York Times.

Iranian state media bin earlier report say local officials for Bandar Abbas dey investigate di explosions dem hear for there.

Earlier for May, one clash between Iranian and US naval destroyers for di Strait of Hormuz bin lead Trump to insist say ceasefire still dey in place.

At di weekend, Trump bin suggest say di sides dey close to a deal, but later tok say im don instruct negotiators say make dem "no rush into" one, while Rubio bin tok say dem fit reach agreement on Monday.

But Baqai respond say: "E dey correct to say we don reach conclusion on most of di issues under discussion... But to say e mean say we don reach agreement, no dey certain - no-one fit make dat kain claim."

According to reports, di memorandum of understanding dem dey discuss involve 60-day ceasefire extension, di reopening of di Strait of Hormuz plus plan for further negotiations ova Iran nuclear programme.

CBS News, BBC US partner, report say US intelligence believe say Iran Supreme Leader Mojtaba Khamenei - wey injure for inside one Israeli strike on di first day of wey kpai im papa and predecessor - dey hide for undisclosed location, wey make communication wit im envoys difficult and dey therefore delay pace of talks wit di US.

According to US media, di discussions no go immediately lead to a final settlement. Dem go likely negotiate contentious issues later, wey include details of Iranian sanctions relief, di release of frozen Iranian funds, and US demands for Iran to stop dia nuclear ambitions.

Di International Atomic Energy Agency (IAEA) estimate say at di beginning of di war, Iran bin get about 440kg (970 lbs) of uranium wey dey enriched up to 60% purity.

Dat na short process away from being enriched further to di weapons-grade 90%, wey theoretically fit allow am to create nuclear bomb.

On Monday night, Trump say di enriched uranium go either be "immediately" turned ova to di US, or "preferably, in conjunction and co-ordination wit di Islamic Republic of Iran, destroyed in place".

US and Iranian forces don observe ceasefire since 8 April. Iran don maintain controls on Gulf shipping through di Strait of Hormuz and di US Navy don try to blockade Iran ports.

US and Israel bin launch wide-ranging strikes on Iran on 28 February, wey spark conflict across di Middle East.

Iran bin respond by attacking Israel and US-allied states for di Gulf, and effectively close di Strait of Hormuz. Di move bin increase di prices of oil globally.