Suspected gunman for White House Correspondents dinner na 31-year-old man wey be wan 'shoot Trump administration officials'

    • Author, Jaroslav Lukiv
    • Author, Emma Pengelly & Thomas Copeland
    • Role, BBC Verify
  • Read am in 5 mins

Authorities don arrest di man wey fire shots for inside di hotel wia di White House Correspondents' Dinner bin dey hold on Saturday night.

Law enforcement say di name of di suspect na Cole Tomas Allen.

Di 31-year-old suspect come from Torrance for Los Angeles region, California.

Afta security agents detain am inside di Washington Hilton hotel, e tell law enforcement officials say im bin wan shoot officials for di Trump administration, two sources tell CBS, BBC US news partner.

For inside Sunday interview wit NBC Meet di Press, acting US Attorney General Todd Blanche tok say dem still dey investigate di motive of di suspected shooter, but "preliminary" findings suggest say im target na administration officials, wey go "likely" include President Donald Trump.

Blanche say investigators now dey torchlight reports wey say di alleged gunman bin assemble di weapon for di hotel, and e say "e no go very far".

"E hardly break di perimeter," Blanche tok, and add say e dey possible say di suspect travel by train from Los Angeles to Chicago, and den to Washington DC.

Citing dia sources, CBS also say at least five to eight gunshots dey fired during di incident.

CCTV footage wey Trump post show as one pesin rush past security officers, wey later turn and chase am.

For one earlier news conference, police tok say di security officials and di suspect exchange fire, but no tok how many shots dey fired.

Washington interim police Chief Jeffery Carroll tok say gunfire no touch di suspect but dem don carry am go hospital for evaluation.

Di suspect na guest for di Washington Hilton hotel wia di correspondents dinner bin dey hold, Carroll tok, and add say e dey "armed wit shotgun, one handgun, and multiple knives".

"At dis point, e be like say e be lone actor, a lone gunman," di police chief tok.

Trump later post one close-up photo wey show one man wey no wear shirt for ground, hand cuffs for im hand and Secret Service surround am.

On Sunday, Trump tell Fox News say di suspect "get plenty hatred for im heart for a while", and e add say im family know say e get "difficulties".

Di US president say di suspect get "manifesto" and suggest say e be "strongly anti-Christian".

US media dey report a history of anti-Trump social media posts from 31-year-old Allen, citing law enforcement sources.

BBC partner CBS News see one written document dem believe say dey connected to di suspect. Oda US media don also report on di same document.

Di document say di gunman wan target members of di Trump administration "from highest-ranking to lowest" and although guests and hotel staff no be di intended targets, dem go dey attacked if necessary to get to di officials.

BBC News neva independently verify di alleged writings, wey dey described as a manifesto and reports say dem send dem give di suspect family members bifor di attempted attack.

Pictures later comot wey show as FBI agents and police dey search one area for one California address dem believe dey linked to di alleged gunman.

BBC Verify don dey look into di online presence of di suspect.

Los Angeles County voter registration records appear to show say e no register any party preference.

According to one Federal Election Commission record, wey BBC Verify see for October 2024, Allen donate $25 (£18) to di fundraising platform ActBlue wit di money wey dey earmarked for Kamala Harris presidential campaign.

Allen describe imsef as a mechanical engineer, game developer and teacher on LinkedIn.

According to im profile, e study mechanical engineering for di California Institute of Technology (Caltech) one highly competitive university, wia e take part for dia Christian fellowship.

E graduate wit masters for computer science for 2025 from California State University, Dominguez Hills. E mark di milestone by sharing one foto of imsef in graduation robes to LinkedIn. E also develop and release one game e call "Bohrdom" to di gaming platform Steam.

On Facebook, fotos of Allen - wey BBC Verify match to dos of im arrest for di Washington Hilton hotel - show am dey smile inside family photographs for Christmas and graduation events.

For December 2024, C2 Education name am teacher of di month. C2 education dey offer tutoring and college test preparation to students, according to di organisation Facebook post.

E don serve as part-time teacher there since 2020, im LinkedIn profile tok.

Jeanine Pirro, US attorney for Washington, say di suspect now dey face two charges - e use firearm during one crime of violence and assault on a federal officer using dangerous weapon.

She add say dem go formally charge am on Monday, 27 April for di federal court.