US musician D4vd dey charged wit murder of 14-year-old Celeste Rivas Hernandez

Read am in 5 mins

US singer D4vd don dey charged wit murder ova di death of 14-year-old, Celeste Rivas Hernandez wey dem find her deadi body inside Tesla for September.

Di Los Angeles county district attorney office tok say di 21-year-old, David Burke wey pipo sabi as D4vd dey charged wit first-degree murder for di killing of Celeste Rivas Hernandez.

Her family report say she dey missing for April 2024 wen she bin dey age 13, but she die at age 14.

US police authorities, arrest D4vd on Thursday, as im be di prime suspect in di murder of Celeste Rivas Hernandez, afta dem find her body inside im Tesla.

Inside one statement, after dem arrest am last week, im lawyer tok say, "actual evidence go show say David Burke no kill Celeste Rivas Hernandez and no be im cause wetin kill her".

On Monday, Los Angeles County District Attorney Nathan Hochman announce say dem don charge singer D4vd wit murder.

Hochman tok say na "brutal and horrific murder" na im hapun to Celeste Rivas Hernandez, wey bin dey age 14 wen dem mutilate her body and kill her.

Hochman tok say di charge involve plenti sexual acts wit minor, or girl wey be 14-year-old, and di mutilation of her body.

Di DA office fit ask for death penalty for di case, Hochman tok.

"A parent nightmare na situation wia your daughter go outside one night and e no come back," e tok.

Hochman tok say D4vd dey face three-count charges

Burke dey face first-degree murder charge, wit special circumstances of "lying in wait" as Celeste follow am go im house.

Di second charge na additional special circumstances of alleged murder for 'financial gain'. Hochman accuse Burke say e kill di 14-year-old girl to protect im lucrative musical career wey "Celeste dey threaten on dat particular night."

Di third charge na for killing pesin wey fit be witness to di investigation. E tok say dem go provide evidence say Rivas na witness for investigation of sexual act wey Burke commit wen she dey under 14.

'We need to dey sure say nothing we do or tok go ever jeopardise dis case' - Los Angeles Police Department

Los Angeles Police Department Chief Jim McDonnell don respond to criticism of how police take handle di case and dia decision, dem say dem no go provide details since dem discover di body for Hollywood tow yard seven months ago.

Rivas Hernandez family neva say anytin publicly about di case.

"I wan clear one sometin. My duty no be to start speculation. Na to deliver justice, and dat one go require patience and discipline from everybody part," McDonnell tok.

"Dis investigation dey driven by single purpose to secure justice for Celeste Rivas and for di people wey love am. We need to dey sure say notin we do or tok go ever jeopardise dis case."

E add say di condition of di teen dead bodi delay how dem fit determine how she take die.

"Di time wey pass between her death and di discovery", evidence don dey degraded or disappeared, e tok.

BBC don contact D4Vd lawyers for comment.

Timeline of wetin don happun so far:

8 September 2025

Dem find di remains of 14-year-old Celeste Rivas Hernandez in di front boot of one Tesla for Hollywood tow yard, afta authorities receive report say bad smell dey come out from di car.

Di decomposition of her body show say she don already "die for many weeks", di investigators tok.

Dem no announce di cause of death publicly and dem don seal di court records for di investigation.

Di car, belong to 21-year-old singer D4vd.

19 September 2025

D4vd - real name na David Anthony Burke - e bin dey on world tour promoting im debut album, but e cancel di remaining tour stops for US and Europe.

February 2026

Unsealed court filings show say D4vd be di target of one grand jury investigation into di murder. Im representatives tok say e dey cooperate wit di police.

16 April 2026

Seven months afta dem find her body, Dem arrest D4vd on suspicion of murder. Di Los Angeles Police Department tok on Thursday say dem dey hold di 21-year-old without bail.

Who be D4vd

David Anthony Burke, wey pipo sabi as D4vd, na singer from Houston, Texas. Pipo sabi am for im indie-pop hits like Here With Me and Romantic Homicide

Afta e teach imself music production, e release im debut EP, Petals To Thorns, for 2023. Dat same year, e land on Variety Young Hollywood list and open for SZA on her SOS tour.

E release im first album for April 2025, e gada 22 million monthly listeners on Spotify and nearly four million followers for TikTok.

Police arrest am last week becos e be di prime suspect in di murder of 14-year-old, Celeste Rivas Hernandez

Afta police authorities find Hernandez body inside one car wey dey registered under im name, di singer cancel im world tour and hide from di spotlight.

Who be Celeste Rivas Hernandez

Dem don report Celeste Rivas Hernandez missing since April 2024.

She be first-generation daughter of immigrants parents from El Salvador, she dey live about 75 miles (120km) from wia dem find her body.

Investigators find her decomposed body inside cadaver bag inside di front booth of one Tesla wey belong to D4vd, according to court documents.

Dem find di seventh-grader body di day afta she suppose turn 15.

Neighbors tok say di girl dey visit corner store almost everyday to buy candy and soda, according to Los Angeles Times.

Late last year, her family start fundraiser to help for funeral expenses, dem tok say she be "beloved daughter, sister, cousin, and friend"