'We neva get peace of mind afta dem kidnap our children wen dem dey write exams for Borno'

A woman crying

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One mama wey bin cry afta Boko Haram bin kidnap her daughter for Chibok for 2014
Published
Read am in 4 mins

Parents of di students wey terrorist kidnap wen dem dey write dia Neco exams for Govment Secondary School, Lassa, Askira/Uba Local Govment Area of Borno State, say dem don dey inside serious fear and tension since di incident happun.

Some of di parents tell BBC Hausa say since Monday morning wen dem hear about di attack, dia lives don change bicos till now dem neva know wia dia children dey or even wetin don happun to dem.

Dem say wetin dey worry dem pass be say till now, authorities neva give detailed information about how many students dem kidnap and wetin dey happun wit di efforts to rescue dem.

One resident of Lassa, wey no wan make dem mention im name sake of security reasons, tell BBC Hausa say e rush go di school afta e hear gunshots, but wen e reach, e see pipo dey run to save dia lives.

"My children survive, but many pipo still no know wia dia children dey. We don go hospitals and places wia security pipo gada survivors, but we neva see dem. Now, di only tin we fit do na to pray."

E tok say dem believe say di attackers kidnap at least 50 students, although security pipo later rescue eight of dem.

One mama tok say since she hear say dem attack di school wia her daughter bin dey write exam, she never get peace of mind.

"We send our children go school make dem write exams. We never tink say dem go carry dem comot from dia classrooms. We pray make God bring dem back to us safely."

Reports tok say di attack happun around 9am on Monday, wen students still dey write dia NECO exams.

Witnesses tok say some suspected ISWAP fighters enter Lassa town on motorcycles and head straight to di Govment Secondary School afta dem pass through di town market wey dey open evri Monday.

As dem reach di school, dem begin shoot, and evriwia scatter as students, teachers and oda pipo for di school compound begin run.

Dem later kidnap some of di students and women wey dey sell food for di school compound bifor dem escape enter bush.

Di Public Relations Officer of Borno State Police Command, DSP Nahum Daso, confirm di attack.

E tok say security forces clash wit di attackers shortly afta di attack and stop dem from achieving all wetin dem plan.

"Di attack on Lassa Govment Secondary School happun around 9am. Di attackers open fire and kidnap unknown number of students. Di Commissioner of Police don deploy di Askira/Uba Area Commander wit additional security personnel, and dem still dey search for di attackers inside di bush," e tok.

E add say di police never finish assessing di exact number of pipo wey dem kidnap bicos investigation still dey kontinu.

Boko Haram insurgent for Nigeria

Wia dis foto come from, BOKO HARAM

Wetin we call dis foto, Boko Haram insurgent for Nigeria

Dis attack wey don happun again raise fear among residents of Borno State, wia insurgent attacks still dey threaten pipo lives despite authorities' claims say dem don make progress for di fight against di insurgents.

Even for May dis year, suspected Boko Haram militants attack Mussa Primary School and Junior Secondary School for Askira/Uba Local Govment Area.

Dat time, di Senator wey dey represent Borno South, Ali Ndume, tell BBC Hausa say 42 children, including secondary school and primary school students, plus some children wey dem carry from dia houses, bin dey kidnapped and still dey missing.

Although security officials tok say dem don launch investigation afta di attack, di incident once again show di serious security challenges wey di region still dey face.

Since 2014, wen Boko Haram militants kidnap 276 school girls from Govment Secondary School for Chibok, schools for some parts of northeastern Nigeria never really get peace from insurgent attacks.

Some of di Chibok girls later regain dia freedom, while some escape by demsef, but till today, nobodi know wia some of dem dey.

Security experts tok say di kontinu attacks for southern Borno show say Boko Haram and ISWAP still get di capacity to carry out attacks for areas wey far from major security forces bases.

For di families of di Lassa students, dia biggest prayer right now na to see dia children again.