Puerto Rican boxer Prichard Colon die 11 years afta brain injury wey e sustain from fight

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Bobbie Jackson
- Role, BBC Sport journalist
- Published
- Read am in 2 mins
Prichard Colon, wey bin suffer severe brain injury during one fight for 2015 don die at di age of 33.
Na im father, Richard confam di tori on social media.
Colon collapse for im changing room afta di fight wit Terrell Williams.
Na during di fight im bin complain about repeated punches for di back of im head.
Di Puerto Rican bin suffer brain haemorraghe and afta im do operation to reduce di brain swelling im bin enta coma for 221 days.
Colon live di rest of im life like vegetable - im no fit waka or tok - and im bin need 24-hour care.
"Good morning, my pipo. I regret to inform you of di departure of my son Prichard from dis earthly world," Na wetin Richard Colon write for Facebook.
"Now im dey for beta world. I bin do evritin possible to fulfil im wish, im dream to come on vacation to Puerto Rico na im desire, but e no fit happun.
"Thank you for so many years of love and prayers. As much as you can, abeg keep us for your prayers."
Colon bin dey undefeated for 16 fights wit 13 wins by knockout bifor im face Williams in Fairfax, Virginia.
During di light-middleweight contest, Colon bin appear to dey struck for di back of im head on several occasions and Williams bin deduct point for illegal blows.
Colon bin remove two points for one low blow and dem bin knock am down for di ninth.
Im bin believe say di fight don end, Colon corner team bin remove im gloves and dem kon disqualify am.
His parents bin file lawsuit wey dey seek more dan $50m (£37m) in damages against di ringside doctor and promoters wey dey connected wit di fight.
Dem neva still settle di lawsuit
'A true warrior'

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post






