Why Ghana traders dey question security deal wey Ghana and Burkina Faso newly sign - Wetin dey inside di deal

Ghana Acting Minister for Defence Cassiel Ato Baah Forson and Burkina Faso Minister of State and Minister of War and Patriotic Defence, Major General Célestin Simporé

Wia dis foto come from, Ghana ministry of defence/Facebook

Published
Read am in 4 mins

Ghana National Tomatoes Traders and Transporters Association don announce say dem no too sure about di practical implementation of one defence deal between Ghana and Burkina Faso - dem say especially di part wey tok say security personnel go escort traders along important cross-border trade routes.

Burkina Faso dey deal wit bloody jihadists insurgency wey dey get veri big impact on trading activities for di kontri.

Chairman of Ghana trader association, Eric Osei Tuffuor tell BBC say most areas wey dem dey buy tomatoes for Burkina Faso na designated hotspots and authorities don advise say make dem no go dia.

"Dem bomb one of our trucks. E don dey dia for two years now. I petition Ghana mission so dat dem go fit assist us to get back di vehicle, but notin come out of am. So how you wan take convince me say Burkina Faso govment fit escort me to area wey dem already don declare as danger zone?" Eric Osei Tuffuor tok.

E say officials of di two kontris neva brief dem on how dem plan to execute di security agreement.

Na on Monday, Ghana and Burkina Faso bin sign one ogbonge defence cooperation agreement to provide security to traders.

Di agreement include intelligence sharing and military escorts. Na security arrangement wey be say if e dey successful, oda West African kontris go fit adopt am, following strained relations between di regional bloc Ecowas and members of di Alliance of Sahel States.

Di Acting Minister for Defence Cassiel Ato Baah Forson and Burkina Faso Minister of State and Minister of War and Patriotic Defence, Major General Célestin Simporé, sign di agreement.

According to di statement for Ghana Ministry of Defence, di aim of di deal na to safeguard economic stability, secure critical supply routes and strengthen bilateral defence ties between Ghana and Burkina Faso

Ghana dey mostly import fresh tomatoes from Burkina Faso wey worth ova US$22 million evri year.

For April, Burkina Faso bin lift one ban dem impose on tomato exports to feed dia local industry, wey don make way for Ghanaian tomato importers to resume dia business activities.

Ghanaian traders don express concern ontop dia safety afta one jihadist attack earlier dis year wey lead to di deaths of eight Ghanaian traders.

Di new security arrangement fit help reduce transport costs sake of di reduced risk, but to implement am fit run into practical difficulties.

Burkina Faso army already dey battle jihadists on multiple fronts for di kontri and to deploy additional troops and logistics to escort traders fit stretch di military beyond dia limits.

While heavy presence of troops fit serve as warning, escort convoys fit also bicom potential targets for JNIM militants wey dey operate for southern Burkina Faso along Ghana northern border.

Security analysts believe say militants from di Al-Qaeda-linked JNIM group don already dey use Ghana as safe place to hide and as important route to move supplies. Sake of dis concern, Ghana govment don increase military presence for di northern borders to tighten security.

So far, Ghana neva suffer any direct attack from jihadist groups.

Di success of dis new security arrangement go depend largely on funding and coordination.