Chad president free opposition leader Masra

Wia dis foto come from, JORIS BOLOMEY/AFP via Getty Images
Chad president Mahamat Deby don free opposition leader and former Prime Minister Succes Masra.
E also clear im record from di prison.
Masra bin dey serve 20 years jail term but dem pardon am wit eight oda opposition members wey dem detain during one organising protest.
Meanwhile, dem also reduce di sentence of oda members wey dem detain across di kontri.
Di pardon wey dem grant Masra and di oda eight political actors, no mean say dem don get amnesty.
Dis mean say dia sentence still dey ground for prosecution, di Presidency announce.
Succes Masra
40 year Masra bin dey named as prime Minister for January 2024 by Gen Mahamat.
Dis one bin come afta di deal wey di DR Congo President Felix Tshisekedi bin arrange afta di October 2022 protests.
E run under di Transformers Party wey e bin form for 2018. Di Supreme Court bin no gree am make e run for di 2021 presidential election and e still call out di Deby family rule.
Dat time, opposition call out im candidacy say e wan run on behalf of Mahamat but e say e no get any plan to share any power wit am.
Im campaign promise wey e bin tok give France tori pipo for April na say, "I wan be di head of solid state of Chad, a reliable partner wey France fit work wit. And for dis reliable partnership wey I wan develop, some tins go dey for di past century."
Bifor im join politics, Masra bin work as economist for di African Development Bank (AfDB).









